Men Dey Reason - S01 E58

Story 2 years ago

Men Dey Reason - S01 E58

Read Story: SEASON 1 EPISODE 58

“guy i pity Tega oh, that O”femmanu Officer don

lock am up for 2days now” I said as we walked to

Ade’s barber’s shop.

Yes, Ade’s barber’s shop was where we were

headed to. And don’t ask me what we were going

there to do, because if you ask me my answer

would be, “when we reach there you go know”.

“but Flow ehnnn Tega put you for small wahala

that day oh, sotey u begin dey mess like mumu”

Brainbox said. “una dey Mad, una no fit tell them

say no be me be Tega abi” I said. “if we tell them,

them no go believe us na, and we want make dem

show you pepper small” Man said, and they both

laughed.

“But after we go where we dey go now, make we

try reach police station go see Tega” Man

suggested. “yes we go go, we go even buy food

for canteen go give am” I said. “when him dey

chop that O”femmanu Officer kporkpor, him give

me chop? I no go follow una go abeg” Brainbox

said.

“but you dey chop the things wey him dey bring

come house abi?” I queried, “how i no go chop?

Shey you no see as him cause make them carry all

of us for Police Van go Police station? Like say we

be thief” Brainbox said, “but them no do us

anything for Police station na, them just free us”

I reminded him. “na because Tega beg the

O”femmanu Officer nahim make she free us” Man

said.

“but women wicked oh, see as Tega dey for

station since Two days now because of say him no

wan dey wayah the O”femmanu Officer again” I

said.

“Man, na Ade place we dey go so, we go tell am say

make him help u market them ur necklace” I

informed. “Flow eeeh! You be correct man, my

mind no even go there” Man said.

“u go let Brainbox use Yoruba tell am, as Brainbox

sabi speak Yoruba” I said. “no wahala” Man

agreed.

We got to Ade’s shop to meet Ade seating alone

wearing a gloomy face. Quite unusual. “Ade how

market na?” Man asked. “Market bad oh, market

bad well well” Ade replied.

That was the first time since i knew Ade that his

barber’s shop was without customers. “abi na

because Paco don open barbing salon near your

own?” Man said. “i no know why oh, e be like say

people no like my hair cut again, i no know wetin

dey happen oh” Ade said with a frown.

“you know wetin dey happen abeg, your

Otumorkpor no dey work again, your friend Paco

don pack all ur customers with him Ibo Otumorkpor

wey pass ur O”femmanu Otumorkpor” I almost said.

Previous Episode

Men Dey Reason - S01 E57

Next Episode

Men Dey Reason - S01 E59

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E31
Story | 2 days ago

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E31

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E30
Story | 2 days ago

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E30

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E29
Story | 2 days ago

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E29

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E28
Story | 2 days ago

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E28