Men Dey Reason - S01 E155

Story 2 years ago

Men Dey Reason - S01 E155

Read Story: SEASON 1 EPISODE 155

Her parting frame was the direct opposite of

her B’.reast, it was as flat as my Technical

drawing board when i was in secondary

school.

“bye bye!” I waved her.

“Flow that your babe fine oh” Tupac walked

towards me.

“guy she no fine like that for my eye oh” I

responded.

“you blind na” He said.

“na your Papa first blind” I cursed.

“ehennnn! Tupac you don bring another

market for necklace abi?” I inquired.

“yes i don bring plenty market, fine fine ones,

na yesterday i bring am” He replied.

“okay i go come after make i come take my

own necklace” I said as i walked into our

room.

All eyes were on me. I saw Brainbox hurriedly

left were he sat to seat elsewhere.

“una wicked oh, una no see Me and Man for

three days, and una no ask wetin happen to

us” I angrily said.

“guy we think say una don die na” Brainbox

said.

“na all of una go die, no be us” Man who just

came out of the bathroom said.

“guy na true oh, Tupac and Bigie tell us say

Policemen shot una gun, una com die, them

the Policemen com carry una dead-body go”

Baba jay said.

“we dey morn una nahim make we no open

Barbing salon for two days” Snoop said.

“you no see say all of us wear black shirt?”

Brainbox said.

“yeeeeeeeh! I go kill Tupac and Bigie today” I

and Man yelled as we dashed out of the room.

“Bigie e no go better for your Papa? Na you

go die” I grabbed his shirt firmly.

“wetin i do na?” He shouted.

“why you tell them Snoop say we don die” I

queried.

“na Tupac say make we tell them like that oh,

na play na” Bigie cried.

“which kin play be that? Them dey use death

play?” I queried.

“God save una say i dey happy today, i for

show una wetin make them dey call me Flow” I

freed him.

“wetin make them dey call you Flow sef?” I

asked myself.

“na because i be strong man na” I told myself.

“dey there dey decieve yourself, you no get

Talley like Man, you dey say you be strong

man” I heard a voice. I thought it was Bigie’s

voice.

“wetin you talk? You dey curse me abi?” I

yelled at him.

“i no talk anything oh? How i go curse you”

He answered.

Who said that then? I asked myself. Maybe an

Angel did. Angel of Talley.

Just then, i saw Man walked towards where

we stood.

“so na only me stand here dey hala for Bigie

since, this mumu Man no even follow me” I

said within.

“but wetin we tell them na true na, una two be

like people wey don die” Bigie said and ran.

“na your Papa go die” Man chased him.

“Man leave am na, no pursue am” Immediately

i said that, an Iroko tree fell.

Previous Episode

Men Dey Reason - S01 E154

Next Episode

Men Dey Reason - S01 E156

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
Buying My Step Sister - S01 E13
Story | 2 days ago

Buying My Step Sister - S01 E13

Buying My Step Sister - S01 E12
Story | 2 days ago

Buying My Step Sister - S01 E12

Buying My Step Sister - S01 E11
Story | 2 days ago

Buying My Step Sister - S01 E11

Buying My Step Sister - S01 E10
Story | 2 days ago

Buying My Step Sister - S01 E10