Must Read: My Experience With an Upcoming Artist

Episode 7 years ago

Must Read: My Experience With an Upcoming Artist

Kodekeys …how far naw..

Fyn boss. Tujaguar said he is on his way
Okay mr guitarist…… .So as i was saying mgoat.

Even naw sef i gats pay people for endtime fm like 30 k for radio plays.. i gats promote am , djs, clubs., no be joke oo bruv
baba na you… help my career small naa..

Lol …..no whine me jare.’we just dey hussle am ni…Make one label just sign person naw
Lol..God go do am… soon
Amen… we don suffer too much.

we go blow soon like bokoharam
Lol ( general laughter )
Hahaa
Dats it my brother
All this money na apart from d models money oo.

Mtcheww. Those bastards model …

Hahaa wetin happen
Me i no go rent models for this last video. I just holla like three hairdressing salons for my hood, talk with dem owners and give them small cash make dem help me reason theiir beautiful customers for my video shoot.

Ehn
See u , time no day naw. I also gave body cream sellers and hair dressers to paste the advert and leaflet in their shops and any interested lady with d requirements will always show up.

Ehn..what about the money
Money??

Yes money to pay dem now
Haha see u , me wey i go don pkg for poster with chains, gold and everything.. Most of dese ladies are cheap jare. Ordinary appearing in a music video sef is enough for them .. afterall, dem go chop suya and drink wine in red cups at the video shoot nd we go show their face for d whole world . that one no do dem ??

( general laughter)
Why u con stop to dey use models gan gan
O boy forget that side jare
Abeg radius i wan know jare .. abeg
Na one model F**K up , u no dat safarigirl model

Ohh that one wey everybody dey use, wey get yansh like this

Ehn wey dey dance for every video
Yes
So me and my former manager ,
Mushack
Yes ….we arranged with d babe and she gree 50k plus she helped us to get 4 more girls like that..

Previous Episode

Must Read: My Experience With An Upcoming Artist

Next Episode

Must Read: My Experience With An Upcoming Artist

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6