Danfo wahala - S01 E24

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E24

Read Story: SEASON 1 EPISODE 24

The bus wey I enter today just full of mad people, I dey regret why I even enter the bus .

We dey go , driver dey speed like mad goat wey no get control. I don dey fear wetin don dey my mind be say I must buy my own motor so pesin no go kill me with his reckless driving .

One police car speed reach our bus . I don dey thankGod but I know no say the police sef dey craze. Me wey dey think say the policeman want stop our driver to tell him to slow just see say the police dey ginger the driver say make him drive faster.

Driver eyes don turn red, him sef add more nitro speed up, the police car too dey speed. wetin come kill the matter be say the police come tell driver say “make dem do first to reach race ” for my mind , is like these yeye driver and mad police want play fast and furious with our lives o. Abi dem dey mad ni?

Na today I witness all those skills wey dem do for fast and furious 7.

Oboy this our driver be dey drive like “Dominic toretto” while the police dey drive like ” Paul walker” . Oga police don overtake us but when the passengers come ginger driver say if him lose this race them no go pay him t-fare but if him win dem go give am double I come confam say the passengers sef dey craze ,for my mind I dey cry .

Please make una pray for me as I dey write we still dey inside bus ooo, I dey witness fast and furious. I don promise God if him save me I go join ushering department for churh?

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E23

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E25

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
The alpha’s omega mate - S01 E15
Story | 1 day ago

The alpha’s omega mate - S01 E15

The alpha’s omega mate - S01 E14
Story | 1 day ago

The alpha’s omega mate - S01 E14

The alpha’s omega mate - S01 E13
Story | 1 day ago

The alpha’s omega mate - S01 E13

The alpha’s omega mate - S01 E12
Story | 1 day ago

The alpha’s omega mate - S01 E12