Read Story: SEASON 1 EPISODE 25
Danfo wahala
I don dey inside bus , siddan for my normal position dey listen to music. Driver don start bus, as we dey move I no know the issue between driver and conductor. Both of them just dey para for each other . Be like driver no trust his conductor with money because driver dey complain say money wey him give am no complete. The conductor dey talk say e no cheat am..
As the argument don dey heat up na so driver park one side and tell the conductor to leave his bus, passengers shock and driver almost blow am sef.
Na so conductor give driver money wey dey his hand before driver go say make him count am…conductor don jakpa like thief wey escape from benin prison during Endsars protest .
Na so driver curse am say him be Ole, say e no go.better for him .
passengers, don dey halla for driver make him start bus make we comot. me i know talk sha, i just dey observe, conductor don chop am mugu sha???. Run wey conductor run, dem no born Usain Bolt well to run am .
But why conductor go thief driver money nah, people no get joy for this Lagos o.
Anyways, i just siddan for back dey listen to music and nodding my head like agama lizard wey fall from tree top.
DanDanfo WahalahDanfo Wahala
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}