Read Story: SEASON 1 EPISODE 23
Absolutely nothing just one auntie wey been dey press her phone inside bus and she dey occasionally smile and laugh. Na only she and herself know wetin dey make her laugh carelessly like goat wey dey chop grass.
E don reach when she come laugh uncontrollably , na so she mess inside bus and the thing make sound like Christmas banger .
Shame catch auntie laugh but the baddest part of it be say, her mess dey smell like burnt offering, as in like barbecue rotten fish .
Anyways, nice one from driver wey get air freshener inside bus . Him just help us spray am inside the bus . Himself , instead of spray the thing small small, him dey spray as if him want kill mosquitoes wey from hell fire come.
Wo, me I siddan. For back, I wear my nose mask, put my new earpiece, listening to music and nodding my head like agama lizard wey fall from tree top.
Danfo Wahala
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}