Danfo wahala - S01 E19

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E19

Read Story: SEASON 1 EPISODE 19

Small thing some passengers go dey follow conductor dey shout, many times e no even pass change matter . Make una dey take am easy with conductors coz some of the dey get anger issues make dem no use vex comot your teeth inside bus one day .

So e happen say this girl been dey follow conductor dey drag , is like conductor dey delay to give her change though him dun first tell her say him no get change and she still givam #1000k . Na for #800 she dey shout like mad dog, is like she sef get anger issue. The guy wey siddan near her try to tell her to come down base on say she dey make noise na so auntie anger issues use vex shout back for this guy o . The thing even surprise driver wey make him ask her if she get marine spirit .

Me sef wey siddan for her back dey even fear to talk to her make I no collect free slap , I just say make I mind my business, listen to music and nod my head like agama lizard wey fall from tree top coz na him dey sweet me pass .

Conductor sef dun notice say auntie anger issue get touch for head , so him no kuku follow her shout sef . Him hustle give her back her change , everywhere come calm.

We dun reach last bus stop , as people dey come down , e dun reach auntie anger issues turn to come down , I know no wetin happen she hit her head for the danfo door as she say make she rob her head while coming down from the bus, na so she fall o . Wo, conductor no even do as if person fall for his front, him kuku tell driver to go . Double wahala for auntie anger issues as she dey rob her head and she dey try to stand up . Well, na agbero come help her stand up shaa , e sure for me say dem sef go bill her onto say dem help her stand up coz dem sef no well at all .

Oboy, me I don Waka go my way, listening to music and……………….?????!!!

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E18

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E20

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
The Private Driver - S01  E04
Story | 19 mins ago

The Private Driver - S01 E04

The Private Driver - S01  E03
Story | 24 mins ago

The Private Driver - S01 E03

The Private Driver - S01  E02
Story | 29 mins ago

The Private Driver - S01 E02

The Private Driver - S01  E01
Story | 35 mins ago

The Private Driver - S01 E01