Danfo wahala - S01 E18

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E18

Read Story: SEASON 1 EPISODE 18

Person go enter bus greet people dem no go greetam back . E dey pain shaa . Is like when people enter bus like this , them no get joy at all again .

So this guy enter bus and him come siddan for back seat for where I dey . The guy greet everybody, me I greetam back o but the two girls wey siddan with us no even greetam back .

I no even know wetin dem dey form for .

So as guys wey we be, we started talking about the Manchester United vs villareal match of yesterday . Even sef ,the other two guys wey siddan for our front join us for the conversation.

Small thing conductor start to collect money , that guy wey siddan with me tell conductor say him go pay for everybody except the two girls wey siddan with us for back wey no greetam when him greet them . The guy tell us say him win 500k from bet yesterday, him play the match correct score 1:1 and e enter for him . As we still dey talk about the match and many other things , one of the girls wey no greet the guy when him enter put mouth for our talk and she say na Rashford vex her yesterday because him just dey play nonsense. The guy wey win #500k tell her say , how e take consan him and why she dey put mouth for our talk .

The two girls tellam say his attitude and reply is too rude na him guy man tell dem say na thunder go fire both of them . Him remind them how them make him look foolish when them no respond to his greeting when he greeted them when he entered the bus .

Me I just tellam make him forget that one as guy man wey him be , guy man talk say the thing pain am shaa.

Those girls tellam sorry na him guy man tell both of them to GETAT.

Wo, me I don reach my bus stop , I come down put my earpiece, loud the volume nodding my head like agama lizard wey fall from tree top Waka dey go my way .

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E17

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E19

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
What A Deal - S01 E18
Story | 3 days ago

What A Deal - S01 E18

What A Deal - S01 E17
Story | 3 days ago

What A Deal - S01 E17

What A Deal - S01 E16
Story | 3 days ago

What A Deal - S01 E16

What A Deal - S01 E15
Story | 3 days ago

What A Deal - S01 E15