Danfo wahala - S01 E20

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E20

Read Story: SEASON 1 EPISODE 20

E get as you go use Google map for this Lagos, e go carry you enter bush . The kind Waka wey I Waka this evening even the children of isreal wey loss inside wilderness never Waka that kind Waka for their whole lives .

So e happen say road block everywhere, bus sef no gree carry passengers ,no going back no going front . Okada guys don triple the price of T-fare and dem be feeling like Dangote and Otedola. Oboy I dun wait for bus stop , I dun tire , music wey I dey listen begin to scratch my ears sef , I kuku remove my earpiece puttam for my pocket .

One yeye bus come stop infront of us, I no even remember how many people I give smackdown before I enter that bus but I shaa know say I go djn give like 2 people blow for face . Anyways, e no consan me , all of us dey fight to enter bus .

We dun enter this yeye bus wey dey move like tortoise and make noise like cow wey never chop .

Na so driver carry us go enter go slow, infact this go slow no dey move at all . Oboy, me I can’t wait, I come down , na so I start to dey trek . As ayam typing this thing now I still dey trek . Is like I dun Waka from sagamu to Asaba today . I no fit feel my legs again .

Make this money wey I dey save complete shaa make I buy my own car , I dun save like #900 Naira now , today I remove #100 inside buy gala , e remain #800. Hope still dey shaa.

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E19

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E21

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
The Daring Naughty Sleepover - S01 E39
Story | 5 hours ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E39

The Daring Naughty Sleepover - S01 E38
Story | 5 hours ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E38

The Daring Naughty Sleepover - S01 E37
Story | 6 hours ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E37

The Daring Naughty Sleepover - S01 E36
Story | 6 hours ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E36