"Allow ads" and Popups to avoid redirection of your browsers.

Tales of two funny ritualist - Season 1 - Episode 3

Episode 6 years ago

Tales of two funny ritualist - Season 1 - Episode 3

☆☆
.
Girl:
Na which person ynash una dey busy dey share so?

She asked us.

Chaiii, see as fear gripped us. The girl fine enh. See bobby full everywhere. If we lie, the bobby fit slap us. Her height maself na one in town.

Thank God say dem be only two ushers wey dey inside the church and Donflex don pursue one o. Supposing them be two now, no be disgrace we don disgrace ourselves.

We were just looking at the girl like morons. We couldn’t say anything

Girl: na which person ynash una dey busy dey share?

She asked again.

Me: no vex aunty, na him mama ynash we dey share since
I said pointing my hand towards Donflex.

Flex: enh!!!


Flex:
my Mama?

Me: no be your real mama na, na mama iyabo for compound na. The one wey dey always call you my son.

I lied expertly.

Flex: *smiling, he has gotten the hint* aunty na true, na my mama ynash we dey busy share.

Girl: so na church wey be the right place to share am.

Me: *na wetin dey worry this idiot girl na, she no get let human being rest again?*

Girl: i dey ask una!
She shouted

Girl: na inside church be the right place to share am?

Flex: hey, hey, hey!!!

He shouted, that’s why i like Donflex. He no dey take bullshit at all.

Flex: if we share the ynash here how he take concern you?

Girl: enh?

Flex: na your mama ynash we dey share?

Me: can you imagine children of nowadays, they don spoil finish.

Flex: just wait Idris. *facing the girl* na your mama ynash we share?

Girl: you dey craze, the two of you dey craze..

Flex: na your mama and papa dey craze. Can you imagine? How wetin we dey talk take concern you?

Me: wetin dey worry you self. You don mad before?

Flex: you smoke dry weed this morning. If to say you no get big ynash now i for tear you slap.

Girl: hahaha, na dat one you no fit. Your mama no born you well to try am.

Me: you are very stupid. Infact you be field marshal in the field of stupidity. If we carry this case go court you go win?

Girl: why not?

Flex: if them ask you say wether we mention your name for here, wetin you go reply them?

Girl: *silent*

Me: you are very stupid.

Girl: i dey go tell pastor for una.

Me: hahahahahahahahahahahaha

Flex: kikikikikikikikikikikikikiki
I removed one hundred naira from my pocket and Donflex did same

Me: take this two hundred naira for transport abeg.

Girl: iyeee!! Na me una dey do like this abi?

She stormed out angrily why we walked to where our seat was, the front roll.

Me: chaiii, children of nowadays.

Flex: the girl dey mad. Na just useless mouth she dey make, she no fit tell pastor for us.

Me: wetin she won even tell pastor self? Say we dey share ynash.

Flex: kikikikikikikikikikikiki.

Me: thunder fire your laugh. Hahahahahahaha.

I said and laughed.

Flex: you dey craze, why you dey laugh now.

Me: na your useless laugh na im make my laugh to dey laugh now.

Flex: mtcheeew!!!!!!

Like say na witch, we turn the same time and iyeee! The girl dey come with pastor oo..
.
.

Previous Episode

Tales Of Two Funny Ritualist - Season 1 - Episode 2

Next Episode

Tales Of Two Funny Ritualist - Season 1 - Episode 4

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)