"Allow ads" and Popups to avoid redirection of your browsers.

Must Read: Ibo Boy Wey Like Yoruba

Episode 6 years ago

Must Read: Ibo Boy Wey Like Yoruba

“u must pay the fine oh, today u go smell pepper” a man on red T-shirt shouted clinging on my belt, “bros abeg no vex, i no go do am again” i pleaded. I turned and saw another guy giving my guys a hard chase.

“u must pay the five thousand naira fine oh” the guy on red said, “but na only piss i piss na, how i go pay 5k for just piss” i cried. “when i carry u go meet our oga, na 10k u go pay be that, if u do stubborn head i go use dis thing hite u for head and ur p’rick go disapear” the guy said bringing out what looked fetish, comprising of feathers and broom- sticks. “yekpa!! I no want make my p’rick disapear oh, my p’rick still dey do plenty work oh, i still dey use am well well oh” i confessed.

I saw the other guy dragging Ilorin to where we stood, “so them don catch Ilorin but him no piss na” i tot. “chairman i no get 5k oh, abeg, abeg” i pleaded, ” u dey mad, u no c wetin dem write there before u piss there?” he queried clinging on my singlet. “leave my singlet oh, u no know say na original BYC” i almost said.

“bros ejór oh, émà bínu, i no piss na abeg, abeg” Ilorin begged the pot-belly guy that was holding him. “but why u no tell ur friend make him no piss here na?” the pot belly guy queried bringing his own fetish “juju” out. As Ilorin saw it he said, “bros i tell am oh but him say if una come him go give una the money, say him get money plenty” “haba!! Ilorin why u dey lie, na wetin i talk?” i shouted at the top of my voice.

“so u get money abi?” the guy on red asked bringing his head close to mine for me to notice his bad breathe. “i be like person wey get money? I get money nahim i wear this kin trouser?” i said pointing at my wishy washy trouser. “u no get money abi, i go hite dis tin for ur head so u no go get p’rick again” the guy holding me threatened. I tot i heard Ilorin laughed at that moment, on the contrary he was grumbling.

The tot of losing my most precious d’ick made me cry out saying; “i go pay oh! i go pay oh! But na 3000 naira i get oh” “ok, where the money?” the guy on red asked, i was eased a beat that he actually agreed to collect 3000 naira “e dey house, make this my guy go bring am come” i said. I gave Ilorin my house key ordering him to collect only 3k out of the 5k remaining under my TV.

Previous Episode

Must Read: Ibo Boy Wey Like Yoruba

Next Episode

Must Read: Ibo Boy Wey Like Yoruba

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Black Spot S02E07 - Like a dog
episode | 4 years ago

Black Spot S02E07 - Like a dog

Watchmen S01E04 - If You Don’t Like My Story, Write Your Own
episode | 4 years ago

Watchmen S01E04 - If You Don’t Like My Story, Write Your Own

Bob Hearts S01E07 - Tough Like a Laundromat Washing Machine
episode | 4 years ago

Bob Hearts S01E07 - Tough Like a Laundromat Washing Machine

Kids Say the Darndest Things 2019 S01E05 - Marriage Seems Like a Huge Commitment
episode | 4 years ago

Kids Say the Darndest Things 2019 S01E05 - Marriage Seems Like a Huge Commitment