Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Episode 7 years ago

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Haa..Wetin dey happen ..God..?? This can not be happening to me ?? Wait sef ?? Na kuku 2 sim I get ..mtn service dey do rubbish some times.

Make,I dial the number with my glo line.
” The number you called is not available…Haa ..This cant be happening. By the time i dial am like 13 times,na so i just give up.How i wan take do am God..Na her only number wey i get be dis..I no get any of her friend’s number..The phone wey i suppose use 2go d babe,bin don dey bag..
..
Abi make i reach Their park 4 lag.Dem fit don drop the bag for me ?? Since na government owned,dem no suppose steal my bag except Na one of the passenger take am.

Na only 2go sure oo.She fit don comot her sim,dey use another one wey get Mb browse.. ehn. ..hmmn !! .But dem go don close 4 d park oo.its already 9 pm because na even 8 dem day close 4 ilorin. branch!! if I even meet dem 4 dere,wats d probability say no be one of the passengers especially that nursing mother carry d bag ??

haha.God..
wetin I wan do naw ??
No probelm..No be really the babe fault.i should have told her long before coming. Na me bin wan do stupid suprise..

Soon d cloud dat was already forming since evening,release hin thing…dey pour water for Ground . in English,. It started raining.

There was no nearby place to stay .Under the rain,i had to walk to a nearby vacant busstop before i stop.I decided to rest there..Even though,all sort of dirty things like used Ghana must go bags, Bottles and some other dirty stuffs were placed there, i just had to manage as the rain was so heavy and the water was much .

i bin don fall inside potopoto twice,wey better mud don stain all my already dirty clothes and beards., if i talk say make i go further.find better place,i fit go fall inside again..make i stay here till rain reduce..Make flood no con go carry person away…

Let me just rest here small till i find a better place. My parents ,already disturbed , had tried my tecno line to no avail.

My father had specifically told me to snap myself and send the images to him via whatsapp immediately i arrived Lagos ..He couldnt afford his only child getting lost… Baba go don wait since with no reply.. Man wey get BP before.
” We have all been worried son ” We didnt you call..hope you ok ?? I hope … ..I explained what happened but lied that i was attacked on the way.if i tell him say na bag i forget,the man fit go dey hala them 4 the garage for ilorin,and na so fowl yansh go open.

Oh thank u jesus ” thank you “..i was sure he was rolling on the Ground. He gave thanks and showered prayers on me ,so did my mum who collected the phone and use like 3 mins sama me prayer.
” The interview is now tomorrow abi ”
Yes”
So where are u now ”
” they lodged us in a five star hotel ”
Wow” is it raining there ”
Ehm.dad .i have to rest now so that i will be fit for the job tomorrow.. Greet mummy
” Ok.thats true.He said another round of prayer and admonish me to also be prayerful and corporate .calm and collected as he use like 2 mins give me tips again.

“U shld wear that your red tie oo..U know i even forced u to barb your hair..And this your beards
” Dad.Goodnight. ..The man too dey talk..
Hmmn.See what love has turned me to..Chai..The cold breeze just dey blow my body.. as i dey shiver, they grind teeth. I know it would be worth it..i know.Buh d way i go take tear this babe kpetus ehh.. Then was the process i was still visualing in my memory. when i slept off in my ” Five star hotel ”

Previous Episode

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Next Episode

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Hometown Horror S01E06 - Satanic Swamp
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E06 - Satanic Swamp

Hometown Horror S01E05 - Cursed Dolls of Old Town Spring
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E05 - Cursed Dolls of Old Town Spring

Hometown Horror S01E04- Missing Children of Hannibal
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E04- Missing Children of Hannibal

Hometown Horror S01E03 - Three-Ring Terror
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E03 - Three-Ring Terror