Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Episode 7 years ago

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Make persin praying he for us ” the driver shouted as he started d car,put am for gear1 ,con slot in Ayinla Omowura music for us make we day groove to.

..Na so journey kick start.if i Talk wetin i bin suffer from this people 4 bus hand ,we no go comot here.

Shey na the Guy beside me wey just day fire us with better mess or the nursing mother and her pikin, the medical doctor wey dey sell 12 in 1 herbal drugs take day disturb us or the driver that was telling us his 21 years of experience in driving.. Wetin concern my own abeg.

Me i just day back ,plug my earphone ,they jam Airforce1 ” Such a Diva.” abi na Search a diva.Me sha sabi say na Perfect song for the babe wey i wan go meet as i just dey think different things i go do to the babe if i land for Lag..Hayayaya oo.Cant wait.
.
We just reach Ogbomoso when cars wen dey come bin tell us say robbery dey happen for front ..Shey dem bin don kill two people.

Na so everybody dey shiver ,day shake.Na that time i sabi say people sabi God.Person wey go call jesus call am,person wey go call allah.halla am..

” Let us Go back to Ilorin” na the nursing woman talk .Everyone silent
” wahali ,na true i talk …Choi..Sense i dey oo..wahali.

” O de ri yen so ooo. yes..lets turn back..
.
” Nwanu,will they refund my money ,ego !!if we go back to ilorin “” said one ibo man .

Haa,lets go first oo..They will refund ..Let’s go
No oo.No ooo i cant turn back ooo.we cant turn back,i have an interview today.

Haha “young man ” better alive for another interview, than to die now ” said another man.
Yes”

No no that can’t be possible.we cant go bk!!
” Ok stay here ‘ We are going back ..’ the driver stated.

. Hahaha ..This can not be happening oo.Shey na like this we go just turn back,i cant just allow these idiots to spoil my destiny for me .So i no go fit reach lagos today see this babe be dat,na God go punish devil..

Without thinking, i just rush go where the driver side day, comot the key from the starting box abi wetin dem dey call am,follow my two legs talk as i tear race comot,dey run go bush side
.Na so everybody dey shout …” Werey e mu o .e mu o ” catch him.

I never even run far at all. Wey dem catch me .One of the strong passengers wey bin dey preach gospel for d bus wen we day come na hin first gimme ” Ifase “as i land for ground..

All my cloth been don dirty as them bin dey kick me ,na so dem day wire me slap at the same time untill the driver overpowered me , collect d key from my hand.

Not Untill,one old man conmand say make dem leave me.before dem calm down.

The papa sef yarn say he no fit go back to ilorin as hin must reach lagos too that day .He con say we must wait till everything clear.All d passengers just dey hiss ,dey eye me anyhow,

Previous Episode

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Next Episode

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Hometown Horror S01E06 - Satanic Swamp
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E06 - Satanic Swamp

Hometown Horror S01E05 - Cursed Dolls of Old Town Spring
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E05 - Cursed Dolls of Old Town Spring

Hometown Horror S01E04- Missing Children of Hannibal
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E04- Missing Children of Hannibal

Hometown Horror S01E03 - Three-Ring Terror
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E03 - Three-Ring Terror