Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Episode 7 years ago

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Na 2go room ,naruto room to be specific i bin jam this babe. Before then,i bin dey send card and go credits to guys make dem share me babe.. I turn father christmas,dey give go credits to the needy in exchange for babes as i dey make sure say i dey day online ..i no kukuma get brother or sister wey go help me or wey i go follow dey yarn as na me be d only child of my parent.

Sharply,i add this babe oo..We start chat..

The normal routine how are u.your name and d rest.The babe dey reply sharp sharp .I text now, 3 seconds, she don text back.Haha..

The first day i meet her,na hin she introduce me to sexchat …For 1000 go credits, this babe bin teach me a lot of things oo. we dey chat ,they chat,she day share me pictures ..She talk say her mb finish.i rush buy 200 card,send am to am,we continue.

God don do am.God don do am oo. Na d person be this ..We chatted like this till midnight of that same day.

Na d first babe wey go tell me say she like me be this. hah..Finally after all these years.

This was how we started chatting and talking for four months .In the third month,we officially started dating ……..online dating of course.

Throughout these 3 months period as per say i be responsible boyfriend,i send her 5000 naira per month out of my own jamb lesson allowance and transport fare,to enjoy herself,
.
i send 15k wey she use buy new phone after she no day online 4 3 days and complain sey her phone don spoil,plus a lot of other ” Boyfriend responsibility” wey i do.

The money wey i dey save for bank sey in case of anything ,anything,i withdraw half of am in order to please my girlfriend.All together, plus money wey i lie collect from my mama,plus d one wey i save,i fit say i spend pass 45000 on this babe during these months.

U talk say he too much ??? Haahaa.the babe worth am now.I no get babe afterall this years.

why .i no go treat am well ..After all, she’s beautiful, fine and s*xy** ..With moderate front and back.. Even if she no fine sef i get choice.??

Soon my intention to initially kpansh the babe dey turn to real love for my heart small small…Love is a beautiful thing ..

Previous Episode

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Next Episode

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Hometown Horror S01E06 - Satanic Swamp
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E06 - Satanic Swamp

Hometown Horror S01E05 - Cursed Dolls of Old Town Spring
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E05 - Cursed Dolls of Old Town Spring

Hometown Horror S01E04- Missing Children of Hannibal
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E04- Missing Children of Hannibal

Hometown Horror S01E03 - Three-Ring Terror
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E03 - Three-Ring Terror