Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Episode 7 years ago

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

This matter of babe dem cause me sleepless nights as i even take am serious pass my jamb lessons sef ..Haha.. na 22 i be now ??
I suppose dey 400 level now naa if no be admission wey I still dey look for to study law.

As i dey so,all my guys go dey talk of dem chick way d em catch and how many babes dem don tear, me sef go dey form bad guy ,they shout say i dey tear gan.Deep down,i no say i never kiss girl before ,not to talk of pressing bobbi so how i wan even go near say i bin day tear kpetus .

If dem bin day pass girls around the clique, na wen dem pass am to me,Fk go show.

No be say i no wan do but i no just see d right vessel. And i no wan do ashewo ?? God forbid.. ..

i never sabi how quick i go take come.If i con com after 2 mins.i go pay #500..wey i no go fit change styles again ?? I no want …

Na so i dey go church,weddings.saloons,cinemas,shoprite dey look for babe oo.

He worst reach sotey i be jam one dwarf,we been date one week as i yarn say i wan do the thing, way me bin day think say she no get option than to gree. Na hin she reply ” do u think am in your level ?? Oh i see d mistake i made ..” Na dat day dwarf destroy and break up with me.

I bin no day see success for Social networking dating before so i no too day put focus for matter Like that especially after my painful experience for some nairaland babes hand Like introvert, farano,FlawlessT,Rokiatu,Ishilove and many others wey no go even bother reply my pm.The insult of my life wey i receive from misssclassy and halfrica kukuma discourage me from getting anyone from Nairaland, after all missnora bin day use another person pics dey deceive guys since.

If i been day tell you my experience for woman hand,in order just to lose this my virginity,we go use like 10 episode’s talk am.But bros.,na Ibadan we day go, make we no day divert direction go Owerri .



So you can imagine my excitement when i been jam this new babe for 2go.

Previous Episode

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

Next Episode

Must Read: How 2go Relationship Landed Me In Psychiatric Home

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Hometown Horror S01E06 - Satanic Swamp
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E06 - Satanic Swamp

Hometown Horror S01E05 - Cursed Dolls of Old Town Spring
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E05 - Cursed Dolls of Old Town Spring

Hometown Horror S01E04- Missing Children of Hannibal
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E04- Missing Children of Hannibal

Hometown Horror S01E03 - Three-Ring Terror
episode | 4 years ago

Hometown Horror S01E03 - Three-Ring Terror