Danfo wahala - S01 E26

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E26

Read Story: SEASON 1 EPISODE 26

Danfo wahala .

As e dey be , me dey for back seat dey listen to music . I don tire , infact I weak . I just dey hope make this bus reach my drop point quick quick .

One guy wey dey press his phone , is like him dey for Twitter dey read news . So e get one news wey him read and he exclaimed himself like ” Ah , this country no go kill us o ” na him the other guy wey siddan near him wey ressemble lai Mohamed ask am say wetin happen . Na him Broda Twitter tellam say, him just read for twitter say dem want change the name of Nigeria to United African Republic.

Na him conductor just halla say , even if them want make dem change am to Wazobia e no consan him , nothing go change for this country.

One man wey wear suit inside bus with his newspaper ask conductor why him no get little faith that this country go better . Na him Broda Lai Mohamed carry the matter for head , him tell uncle newspaper say no be by carrying newspaper upandan anyhow and speaking big big grammar, say as him dey like this now whether him like how things take be . Uncle news paper tellam say atleast make him get small hope and faith that things go better .

Driver wey never talk since o just shout say ” oga, hope and faith kill you there, see if you talk anyhow I go change am for you o ”

Broda Twitter ask driver why him dey reply the man harshly like that nah ? Conductor tell Broda twitter that make dem no mind driver say him dey get anger issues , say if him vex now him fit stop this bus make everybody come down . Broda lai Mohamed tell Conductor say the anger issue wey driver get na for him and his family o , make him no try am for where him dey .

When driver hear wetin broda lai Mohamed talk , na so driver stop bus o make everybody come down . passengers want shout , driver kuku off engine carry his key dey go and him leave bus there . Everybody tire , na so everybody come down.

Wo. Me I knew that as many people don dey talk about that UAR matter inside this bus , wahala must sup.

Continuation on Danfo Wahala

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E25

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
His sexual addiction - S01 E43
Story | 2 mins ago

His sexual addiction - S01 E43

His sexual addiction - S01 E42
Story | 6 mins ago

His sexual addiction - S01 E42

His sexual addiction - S01 E41
Story | 11 mins ago

His sexual addiction - S01 E41

My last wish - S01 E45
Story | 3 hours ago

My last wish - S01 E45