Danfo wahala - S01 E06

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E06

Read Story: SEASON 1 EPISODE 6

Going home after tonight football training, I go enter bus wey go drop me for my bus stop. I go siddan for back , very tired because my team collect serious beating 4:0. I enter bus go siddan for back, I no carry my earpiece sef.

Plenty people no dey inside this bus. For back sit wey i siddan , na only one guy wey dey there but him dey sleep. Is like guy man don tire . After like 5 minutes when we Don reach bus stop and people dey come down, na so guy man rushingly wake up like person wey masquerade dey pursue for dream, the next thing wey him talk be say ” WHERE UNA DEY SEE THIS MONEY”. I shock , I tellam say bro calm down o , na inside danfo you dey make the people wey dey pursue you for dream no follow you reach here o .

I jejely come down , enter okada and Waka my way .

Danfo Wahala

Danfo wahala .

These people no go let people rest inside bus with these their Sunday preaching. It is good to preach o but all these bus preachers go collect one day . Dem no know when person dey vex .

We dey inside bus , you know it is Sunday and ur common sense suppose tell you say half of the people wey dey inside bus are either going to church or coming back from church.

So e happen say one bus preacher stand up to preach , as him stand up na so the guy wey siddan near me just hiss like snake wey don see rat to swallow.

As bus preacher start to preach ,na him one man wey siddan near him tell am to wear nose mask so that he will not spit saliva on people face . Na him bus preacher tell the man make him allow the spirit to do his work .

Broda wey hiss like snake ask am which spirit wey him dey talk about . Aaaah, is like this people don’t want bus preacher to talk sef .

Ontop of that , conductor start to collect money . Conductor ask bus preacher money , bus preacher tell conductor that he should wait after him don finish preach and collect offering from people inside bus, he will pay him from there .

One woman wey siddan for front shout ” oga , you are not serious , who want give you offering money ?

Oboy e surprised me as everybody just dey try frustrate bus preacher inside this bus , some even say if dem give offering for bus , wetin dem go give for church?

Meanwhile e get one guy wey siddan with me for back, the guy just dey do like person wey stomach dey pain. For my mind, make this bros no shit inside this bus o.

Wo, me I just siddan dey listen to music and be nodding my head like agama lizard wey just fall from tree top.

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E05

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E07

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
My last wish - S01 E45
Story | 1 hour ago

My last wish - S01 E45

My last wish - S01 E44
Story | 1 hour ago

My last wish - S01 E44

My last wish - S01 E43
Story | 1 hour ago

My last wish - S01 E43

My last wish - S01 E42
Story | 1 hour ago

My last wish - S01 E42