Danfo wahala - S01 E05

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E05

Read Story: SEASON 1 EPISODE 5

Anyhow wey e be, as a passenger, make you try to avoid wahala with people inside bus especially driver and conductor . No feel say you better pass them coz all of us na human beans ?we be .

So e happen say this guy dey para for conductor since wey we dey inside bus and no be say na big thing cause the wahala sef . Just because, conductor mistakenly stepped on his babe when she wanted to enter and she nearly fall down , na him this guy just dey shout like mad dog even though conductor don apologize o.

Even the babe of Broda mad dog sef don tellam make him forget about the matter .

Other passengers sef don dey wonder which kind vex wey broda mad dog dey vex like this sef .

E reach when conductor dey collect money, broda mad dog troway #500 for conductor face and tellam make him give him change . Conductor ask him why him go troway money for his face , him come tellam say him sef fit vex too.

Na him Broda mad dog tellam to do his worse , him even call am animal join. Conductor come vex .His girl friend even tellam say she no like what he is doing inside this bus . I just dey for back dey wonder which kind anger issues be this wey Broda mad dog get, anyways I know say wahala go soon land .

So conductor tell broda mad dog that he will not give him his #100 change as he feels that na only him dey craze . In a few minutes, we reach bus stop and Broda mad dog drag conductor by his trouser because of his #100 change . Slap wey conductor givam , me sef shock , infact e choke me sef.

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E04

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E06

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
The Daring Naughty Sleepover - S01 E35
Story | 2 days ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E35

The Daring Naughty Sleepover - S01 E34
Story | 2 days ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E34

The Daring Naughty Sleepover - S01 E33
Story | 2 days ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E33

The Daring Naughty Sleepover - S01 E32
Story | 2 days ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E32