My WhatsApp Visitor - S01 E62

Story 3 years ago

My WhatsApp Visitor - S01 E62

Read Story: SEASON 1 EPISODE 62

O boy shame catch me, if I say shame no catch me I dey lie. I look the babe look myself, all the years of my experience as player I never jam Barcelona for derby wey strong like this.

My mind just go tabula rasa, that time my phone come ring. God help me say na my Iphone 6 come ring sha… The ringing tone come give me vibes, if to say na my Itel S32 ring. The shame for dey like wind wey dey blow human being commot from ground.

I come bring out my phone come set like big boy.

Me: excuse me lemme pick this important call.

I see the caller I.D na my mumu twin brother dey even call sef, I quickly picked the call and placed on my ear.

Me: you don send the 50k? I no wan hear story.

Victory: which…

Me: I just received the alert as we are talking.

Victory: no problem, nice doing business with you my bro come get the scoop

Me: thank you.

I ended the call and pocket my phone, I gave a heart warming smile to the girl and her friend.

Me: I was thinking you are the one that I can spend on and make mine, it seems like am wrong.

I come turn like all those actor wey don do em enemies better damage and waka dey go.

I strolled away.. I never waka go far when somebody dey come me from behind.

I looked back and saw the girl I gave my charger earlier looking sorry.

Me: hope say no wahala.

Girl: not at all, no vex… I think say you be one of those useless boys wey dey stay for this area.

Me: na my turn to form na oh!

Girl: am sorry, am Victoria.. What is your name?

Me: we be perfect match oh! my missing rib ’cause my name na Victor.

Victoria: blushing you pack in this area new?

Me: yes, just a week. I just come do small work for that company her head turn

Victoria: nice, can I have your number? lets be friends.

Me: no problem.

We exchanged numbers, my mumu brother no even gree me rest with calls.

The babe come peck me before saying goodnight, her yansh na collateral damage. If I no chop this girl with doggystyle I no go gree oh, my brother called again. I quickly picked the call..

Me: guy, I be your wife?

Victory: where you dey, I wan enter house oh.

Me: I dey waka come the barber place, no move oh.

I ended the call and rushed to the barber’s salon and find my twin brother standing at the front of the barber’s shop.

Victory: ashewo.

Me: your second name.

Victory: make we dey go jare.

I no blame am, we waka go house. Light no even dey, thank God say we don fill one drum we dey use cook for inside kitchen. We bought indomie that is what we wanted to eat that night, we nodey in the mood of cooking that night.

I really need a wife oh! shebi? The one wey godey service me and cook for me till I find my real wife, no water for bathing.

I carried my bucket and my brother carried his own, this yard na wahala oh! the tank dey leak water as if em dey cu-m.

When we got out of the gate their are few people by the tap, a woman and two small boys. Luckily I met Oniobong there and I greeted her, and got closer.

She don already fetch her two buckets finish.

Oniobong: you wan fetch water?

Me: no, I come marry you.

Oniobong: clean your mouth. I laugh

Me: only you wan carry the two buckets.

Oniobong: yes na, you wan help me.

Me: yes na, but you go come my birthday party for my house tomorrow oh.

Oniobong: no problem, I go come. Oya help me.

I helped her and carried the bucket of water to her house while coming back my brother was already jacking my own and his, he dropped on the ground and stared at me.

Victory: which day mama born you February fifth wey nobody know?

Previous Episode

My WhatsApp Visitor - S01 E61

Next Episode

My WhatsApp Visitor - S01 E63

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
100 days girlfriend - S01 E90
Story | 15 hours ago

100 days girlfriend - S01 E90

100 days girlfriend - S01 E89
Story | 16 hours ago

100 days girlfriend - S01 E89

100 days girlfriend - S01 E88
Story | 16 hours ago

100 days girlfriend - S01 E88

100 days girlfriend - S01 E87
Story | 16 hours ago

100 days girlfriend - S01 E87