Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 3

Episode 7 years ago

Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 3

…see blood don full my body and I con dey wonder why I no feel any pain, na so person fall down for my side. See big time falling hand, dis men no know say my cloth done stain. Dem no need to tell blind man say market dey catch fire, na so I push the big table take cover the same minute wey I hear the gun shot,, as I con use eyes take survey the people wey dey spray bullet. Na just three guys wey were mask as one waka near us shout say make we submit our property one after the other. Na eem Irumole con won stand up, I just tell am make ee cool down watch film wey won happen. Next tin I just say my last prayer for planet earth and I con carry two star empty bottle con still mark those strong men positions, con wear the hand glove wey I dey use for work wey dey my pocket. I waka small small reach were one dey just jump use the two bottle take clap am for head before he sample me him gun he don reach ground already, before the second one face me I done stone am the two broken bottle wey dey my hand one bottle catch am for chest while the second one meet am for lap na so ee carry ground sit down dey shout like goat wey dem chook knife for neck. Na so I pick the first guy gun, I con dive enter gutter, the last guy just dey wonder wen Jet Lee or say na Jackie Chan start to dey ack Nollywood, he just stand numb dey spray bullet for the gutter were I dey like small pikin wey dem dash new toy gun. Me done already crawl follow the gutter path take find the safest root because the last guy done dey reach were I dey. As I wan come out of the gutter na so the last guy point the gun for my neck, I nearly piss for body but dat one no move me because Irumole self dey point the guy gun for neck. Na so my advantage con advance go stage two like say na Contra I dey play, me self con come face am with the guy as police con surround us.

Big T! Big T!! Big T!!! Turn music for my ear like say GLO pay Psquare make them release song wey carry Big T as for advert for them. The people they hail my name after we settle matter with the police finish. Na him me self turn Robin Hood for the area my talk dey everywhere.

…. As Irumole drop me for front of my compound with one of him ride Accord ‘Deadly Virus 2015 model ‘. Me greet am bye bye sake on say him bab e dey with am he no con branch enter my place. Any which way na way, as I cheek my phone missed call be like 2go credit for my phone Seyi don give 27 missed calls, Fumnanya too miss self, she even send me text say I no try at all say I no fit to call am since morning join some other irrelevant calls. My body dey smell like deady body wey dem no embalm because that gutter wen I dive enter be like succer way pit.

Me dey step leg for compound like army wey return back from war, na so all the certified amebo con ask “kilo she le” *na wetin happen*. Me just dey story dem better lie, wey dey sweet them for ear na. Next tin wey I feel na person wey sq££ze my ear “o mo pe wa ko ko de le no” *you no know say you suppose reach house first* Seyi dey yarn. She no even mind the wey I dey smell like aboki perfume wey sour, she hug me tight me no even care na so I hold am join body too. I con carry her go my room. As I enter my room every where change, ee just be like say dem pimp my room, no dirty all my cloth them done already iron am, no dirty at all, well ee no concern me but the one wey move me na the aroma wey dey erupt my nose. My yoruba love say you carry party food come put for my room. “Ra ra oo moti se oje ka le fun ee but wa ko ko lo we ke to ma jeun*not at all I done cook food wait for you but you go bath first before you eat*” Seyi dey yarn. Ok I done hear oya sereve the food down make I go bath. As I dey enter my room see wetin dey table, ee be like this my yoruba love they skype me for where she be dey, na the perfect combination be this wey I go enjoy. Amala with Ewedu and cat fish with my drink Origin two bottle and maltina na so I sit down, kiss her first, con tell her say she be better love and con tell am those sweet words wey dey make her ear ring. Me won start to dey chop na so I hear Por! Por! Por! Na who con be dis person wey no fit allow me chop first as I open the door I wan ….

Previous Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 2

Next Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 4

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)