Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 2

Episode 7 years ago

Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 2

Hmmmmmmm my body freeze wen I see who open the door. I just stand still like dat horse wey dey front of union bank, na Fumnanya oo, see as she just dey shine like 100 watt bulb. My eyes scan am from head reach ground as if na virus scan no difference with her and coke bottle. Next tin wey I feel na hand wey touch me “Big T good evening and please come inside” Fumnanya dey yarn. I step inside I no even sight oga landlord for the palour. “He is coming he went to take his bath” Fumnanya dey yarn. So na who oga landlord be to you. “Well he is my uncle, I came to spend the semester break in his place” Fumnanya dey yarn. Na which school you dey. “Am a student of Osusu Private University, studying Astronomy, currently in my third year” Fumnanya dey yarn. “Big T ba wo ni, ma bi nu pe mo da e duru *how you dey no vex say I make you dey wait*. Dat room wey you book for before done dey vacant oo, if you done ready I go discount am for you” baba landlord dey yarn. I don hear baba landlord if I don ready I go come see you, good night oo. See this man, na dis useless tin ee call me for or na bad thing say I pack go my own house for Banana island. As I dey waka go my room Na eem I hear ‘Big T’ as I be dey expect before na fine anty dey call me. Me an Fumnanya con sit down for stair case, relate well oo until mosquito carry gallon dey hala fresh blood na so we path way.

Morning no dey tey reach oo, today wey be saturday I no get tins to do na eem I call my yoruba love ‘Seyi’ ask her how she dey and tell am were I drop key in case she no meet me for house. Na tym to do wetin I sabi do well oo for were we people dey read newspaper for morning. See argument wey dey drop like misseles wey dem target. This Mr. Damian na football fanatic oo, ee know inside out even the match wey no concern am. Based on Chelsea win na eem men con dey rant, boil, talk tins wey fit happen n tins wey no fit.

This hot afternoon better no gree come, na eem I carry phone take ring Andrew aka Irumole, Irumole na my personal padi wey sabi d way, de only student wey carry first class Accounting and Finance for him set join Masters in Womanology and no dey carry last for any matter wey carry the #BIG_T. Guy how far na, you no be confirm again oo. “Abeg Big T no vex oo I get pile of work wey nail me down for office” Andrew dey yarn. Ok I don hear, na were you dey self. “I dey for Mama Gbenga Store with that chick wey I yarn you about last time” Andrew dey yarn. No let the babe escape because I dey come there now.

…Irumole! Irumole! Irumole! How far na. Big T I loyal oh, fine girl I greet you oh. Good evening I’m Bellastone by name. Na beta tin say I know you, my guy na confirm oo I trust am reach ground and abeg make you no take am play. “Sure I won’t” Bellastone dey yarn. Na so I stone words enter Irumole head, guy this your girl dey bring smoke oo na dis type of girl dey make everybody hail you for road, na beta eye you get. “You know the matter now” Andrew dey yarn. Gbenga abeg sample me two alomo bitters and one bottle water make I drink. Me con dey yarn Irumole tins wit him babe na so matter con enter Fumnanya based on who Irumole be, he give me better tips take catch the girl. As the talk dey sweet, my phone con bleep twice, chia this wicked flash wey no fit show for MTN call history, as I check am na my yoruba love. I con call her back she tell me say she dey my place already say make I waka dey come fast. Me just wan put the last particles wey setle down for my alomo bitter bottle wen I hear POO! POO! POO! Na gun shot be dat oo next thing wey I see blood don full my body….

Previous Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 1

Next Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 3

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)