"Allow ads" and Popups to avoid redirection of your browsers.

Sexcapade Gone Wrong - Season 1 - Episode 3

Episode 5 years ago

Sexcapade Gone Wrong - Season 1 - Episode 3

Wetin they do you

The Tales Of Ozila Laveda And The Bank


We reach main road that is Aba/Owerri road for Aba na so everywhere
they quiet as if person die, this is unusual because Aba is always
busy till twelve in the midnight even twelve arm robbers they make am
dey busy, we stood opposite first bank there waiting for keke napep,
the first one we saw charge us 300 naira for wetin them they collect
100 naira before just because say na night, hmmm i told him to go
because i cant start spending big now when am not even sure if i will
enter the ocean city.

Lave: all their price will be high today because its late already.

Me: well we will continue to wait till we see the one wey no smoke witch (no time to form big boy she know me already so am not gonna overspend na new catch I they spend for to tell her say our future is bright).
::
we stood there for another ten minutes before we see another one wey the keke old like say na the time of moses them make am, this
one agree 200 naira (I know he will because the keke na eyesaw) so we just enter like husband and wife wey
shattered keke, the driver they ride him they stare at Laveda breast
for mirror I no blame am sha the breast alone na temptation but na wa for am oh and na highway him they oh, i cant
hold myself so i have to voice out. “errm driver concentrate for road na”.

Driver: na wetin concern you na your eye i take look?

::

i look at Laged and she just smile and shake her head i wonder why she
wear this kind singlet like this oh wey no make driver concentrate na
how i go manage her when we reach party because the kind guys wey go
they stare at her fit put me for coma 201.
:::::
i keep myself busy by pressing phone till we get to the hotel thats already booming like
tecno boom J8, i paid the yeye driver and hold lovi hand as we stroll
inside the big compound, we reach the gate and sceurity man look me
from head to toe, him no even answer my greeting self.

Me: bros i they greet oh (i repeat the second time as i hold Laveda on her hand).

Bros: na wetin you they fine here?

Laveda: we are here for the party please can you let us pass?

Bros: no be you i they talk na your boyfriend.

Me: bros na party things na.

Bros: na party na im you dress like say na film you they go act, i nor
fit let you enter oh (see gbege).
::
i look my dress again i nor see anything wrong so i ask him “wetin do
the dress bros?”.

Bros: commot here i nor get your time joor.

Me: see this man wetin they worry you self ordinary security man.

Bros: eeh wetin you call me? (e be like say i charge him battery
because i be nor look am well before as him they waka come meet me na there i know
say men they grab, infact John Cena they learn for where him they.

Previous Episode

Sexcapade Gone Wrong - Season 1 - Episode 2

Next Episode

Sexcapade Gone Wrong - Season 1 - Episode 4

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)