Danfo wahala - S01 E22

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E22

Read Story: SEASON 1 EPISODE 22

Wahala everyday, me I don tire . When two good looking working class young ladies quarrel each other inside bus , make you just kuku know say e get why and the matter long .

So e happen around mile 2 ,inside bus wey I dey . Me don siddan for back already and I want meet up with a business.

All these drivers wey no dey get conductor go dey ask passengers money as if person wan carry their money dissapear. Driver be just shouting like mad dog wey never chop bone since the past 1 year.

Bus stop at a point, people come down and people come in.

E get one slim yellow auntie wey enter , she fine shaa . As slim auntie enter , e get another dark tall lady wey dey inside bus since , she’s been pressing her phone and laughing carelessly like person wey dem chop her brain .

So as slim auntie see dark auntie inside that bus , na so wahala start o . Slim auntie tell dark auntie say , ashawo, you think I will not see you in this Lagos abi ? Dark auntie reply “whatever” , slim auntie fired again and call dark auntie ” boy friend snatcher” na him dark auntie reply say ” coz you don’t know how to take care of him that’s why he ran to me “. Na there slim auntie give dark auntie slap o . Driver sef wey been dey do like mad dog shock as him see that slap . Oboy dark auntie slap her back o .

Me wey dey for back don dey regret why I even enter this bus today . These two ladies don pull each other wig off . Slim auntie head be like pineapple while dark auntie head be like cucumber.

Trust Nigerians with their careless attitude wey dey vex me at times sef, person go dey die , dem no go even care . Na so all passengers wey dey inside bus just mind their business o . Na him dark auntie shout say ” all of una wey dey inside this bus , una no go put mouth for this matter abi ”

One guy wey siddan for back seat reply say ” as una no want get sense , make una Kee unasef”

Wo, me I tell driver to stop this bus , I no want go again .

Danfo Wahala

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E21

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E23

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
His sweet virgin - S01 E46
Story | 2 mins ago

His sweet virgin - S01 E46

His sexual addiction - S01 E30
Story | 3 hours ago

His sexual addiction - S01 E30

His sexual addiction - S01 E29
Story | 3 hours ago

His sexual addiction - S01 E29

His sexual addiction - S01 E28
Story | 3 hours ago

His sexual addiction - S01 E28