Danfo wahala - S01 E21

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E21

Read Story: SEASON 1 EPISODE 21

If I tell una say I never tire for the matters wey I dey see wey dey sup inside bus , na lie I dey lie.

The one wey sup this morning na between a bus preacher and a Chelsea fan wey dey go church.

E happen say small rain dey fall so driver no too dey speed like that. Conductor sef don siddan inside and close the door, him don collect money from passengers finish and him just dey sing Yoruba song . Joy dey conductor body well well.

As I see this man wey siddan Infront of me with big blue shirt, I know say na bus preacher him be.

E no tey, uncle big blue shirt stand and shout praise the Lord . Me I just kuku troway face look outside start to count bridges . Uncle big blue shirt don start his preaching, him dey preach about fake miracles , fake things in church. Many people shaa like wetin him dey talk about inside bus . One slim girl wey siddan near me , just dey shout ride on sir . I be want givam slap but my mind say make I mind my business.

One guy wey siddan Infront wey wear green Ankara like person wey dey go do Thanksgiving for church receive call and him tell the person wey call him for phone say nah #250k him win for that Chelsea match .

When uncle big blue shirt hear #250k, him shout Chisossssssss. Broda Ankara ask am wetin happen , why him dey shout ? Uncle big blue shirt start to tell broda ankara say him carry man City straight win and na 50k him putam but the ticket loss. so na the #250k wey broda Ankara talk say him win shock him.

The girl wey been dey shout ” ride on sir ” shout and ask Uncle big blue shirt say him sef dey play bet? Uncle big blue shirt tell her say na him side hustle.

Uncle big blue shirt no want preach again , him just dey follow broda ankara dey talk about yesterday match and how his ticket wey loss pain him.

Meanwhile conductor still dey on his own lane dey sing his Yoruba music jejely .

To be continued

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E20

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E22

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
His sexual addiction - S01 E30
Story | 1 hour ago

His sexual addiction - S01 E30

His sexual addiction - S01 E29
Story | 1 hour ago

His sexual addiction - S01 E29

His sexual addiction - S01 E28
Story | 1 hour ago

His sexual addiction - S01 E28

His sexual addiction - S01 E27
Story | 1 hour ago

His sexual addiction - S01 E27