Danfo wahala - S01 E15

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E15

Read Story: SEASON 1 EPISODE 15

So e happen say plenty people full bus stop today and bus no dey at all . I don dey there for like 30 minutes but good enough my earpiece dey my ears, loud volume as I dey listen to music from my phone and nodding my head like agama lizard wey fall from tree top.

No social distancing at all sef , me i kuku put my nose mask . This man wey dey near me with his Ghana must go bag just dey cough small small anyhow. Is like him think say Coro na joke .

E get two girls wey come for bus stop too , wetin dem wear fit cause commotion. Very tight transparent wear, agberos sef don dey do tongue like bingo wey want chop born. Na so people just dey look them like maad .

Since that time only 3 buses don come and many people no enter sef coz the T-fare too high .

Two agberos come near the two girls , one of the agberos called dem omo shedibalaba , the other added , shedibolobolo. People wey dey around start to laugh before you know it shedibalaba shedibolobolo queens give slap to the two agberos.

Agberos confuse ,dem feel say na thunder fire them. Agberos want raise voice but shedibalaba shedibolobolo queens don carry stick wey dem go wipe dem . Shame no gree agberos raise their heads .

Shedibalaba shedibolobolo queens just dey para , them dey shout , asking why people be looking at them as if they are spirits .

Wo, me I just dey my side dey peep with one eye wetin dey happen while listening to music and nodding my head like agama lizard wey fall from tree top. Las Las one bus come pack infront of me , ma fight I take enter that bus o , I even hit my head .

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E14

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E16

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
The alpha’s omega mate - S01 E05
Story | 13 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E05

The alpha’s omega mate - S01  E04
Story | 13 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E04

The alpha’s omega mate - S01  E03
Story | 13 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E03

The alpha’s omega mate - S01  E02
Story | 14 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E02