Danfo wahala - S01 E14

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E14

Read Story: SEASON 1 EPISODE 14

Danfo wahala

This morning dey bright, I just dey feel happy this morning even people wey see me just dey ask if I don cash out, me no even answer them cuz e go end for billing Las Las .

I just move go bus stop, I don package my self wella, if you see the way I starch and iron my shirt you go think say na me dey control CBN. Na so I meet one guy wey wear white and white upandan wey starch wella too I don dey feel the oppression sef wetin make am worse be say him hold iPhone x. Me wey think say na me fresh pass, I just humble my sef.

We enter bus broda, white and white tell the woman wey siddan near him say”Madam am not comfortable , can you adjust a little” (His voice thick like big man voice) the reply wey the woman give am na beta savage reply”ok so you want to be comfortable na him you no buy your own motor, mtcheew” the reply make everybody dey laugh my nigga just hold himself ??. Like 5 mins later bus begin make funny sound , before we know , bus no move again.Driver go check wetin dey do the bus , everybody don dey vex say dem go late for work.

Driver talk say we get only two: We go begin dey trek or We come down push the bus until e start??.Me I just come down dey wait wetin the rest go do and i see broda white and white come down and say him go push because him no fit trek with his expensive clothes. I begin laugh dey trek go my way . When I look back , I see broda white and white with other passengers dey push bus, na laugh I just dey laugh . Broda white and white begin Para say make driver refund his money, ? na there yawa bus when driver say him no fit refund??. Everywhere don cast, Broda white and white clothes down dirty we’ll well , I just dey laugh as driver and broda white and white begin quarrel ?. I just continue my trekking as I dey listen to music dey nod head like agama wey fall from tree top.

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E13

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E15

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
The alpha’s omega mate - S01 E15
Story | 21 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E15

The alpha’s omega mate - S01 E14
Story | 21 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E14

The alpha’s omega mate - S01 E13
Story | 21 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E13

The alpha’s omega mate - S01 E12
Story | 21 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E12