Danfo wahala - S01 E13

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E13

Read Story: SEASON 1 EPISODE 13

Danfo wahala

So e happen say a group of people inside this bus, dem reach like six wey dey go for the same church. Is like their church get important program this Sunday . You can see from their dressing as all of them dress like today was judgement day and they be waiting for angel Gabriel to blow the trumpet.

Their dressing make sense but na their head wey no correct .

Anyways , e happen say me I siddan for back seat dey listen to some lucky Dube songs coz na wetin my spirit need that moment, me sef dey go meet my friend for one business like that .

By my side , e get this guy wey just dey sleep and snore like pig wey drink ogogoro . I just dey wonder why person go dey sleep carelessly like this inside bus, if driver carry him Waka pass his drop point now, when him wake up na him go still vex .

So the people wey dey go church just dey put driver pressure make him drive fast coz them don late for church and at same time , dem dey disturb conductor for their balance .

Driver head don swell up coz the way dem dey talk to him, him want frustrate. One of them tell driver say na him suppose lead opening prayer today . Conductor tellam say how that one take consan them and why him no sleep for church the day before so that he will not be late .

One mama wey dey inside bus tell them make dem free driver , that even herself dey go church. So make everybody chill.

At a point , driver off engine when the noise don become too much , him say him no go again and the place wey he off engine, it’s difficult to get bus or okada there so everybody wey dey inside bus start to beg driver say them no go shout at him again .

Conductor wey be driver hypeman just dey ginger the driver make him tell everybody to come down . Na that mama wey dey inside bus convince driver to continue the journey. Las Las the church goers association close their mouth untill we reach final bus stop meanwhile ,broda snoring pig, still dey sleep carelessly.

Wo, me I just siddan for back dey listen to music and be nodding my head agama lizard wey fall from tree top coz I no even get strength of any danfo wahala .

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E12

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E14

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01  E05
Story | 2 days ago

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E05

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01  E04
Story | 2 days ago

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E04

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01  E03
Story | 2 days ago

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E03

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01  E02
Story | 2 days ago

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E02