Read Story: SEASON 1 EPISODE 12
Danfo wahala
This bus wey I enter now dey one kind to me, cus everybody just quiet like say dem they observe one minute silence for person wey don die??. Na so I kuku follow observe the silence, bus don almost full, only 2 places remain , na so one woman wey fat like coolval Stories hippopotamus come enter , she siddan near one aunty slay queen.
For my mind I don dey laugh say madam hippopotamus go squeeze aunty slay queen life.
Bus start to move , aunty slay queen start to complain that madam hippo dey press am, say make she shift small, na so madam hippo start to Para inside bus like person wey bet9ja chop him last money, anoda broda wey siddan for driver side put mouth for the matter , naso madam hippo change am for the bros na so bros humble himself make him no collect slap .
We dey go, inside bus start dey smell as if person mess, everybody start to cover their nose like NCDC officials, me I kuku put my nose mask well ?? , driver stop motor say him no go again , him talk say pesin no fit killam inside his own bus , everybody come down start to trek me I just they pity madam hippo cus she dey waka like who carry bag of dried cement for yansh, mtcheeew I just look away dey continue my journey with leg.
As I dey go i just put my earpiece dey listen to music and i dey nod my head like agama lizard wey just fall from tree??.
Danfo Wahala
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}