Read Story: SEASON 1 EPISODE 11
Danfo wahala
Hunger dey this country shaa, so e happen that I enter one bus wey something funny happen.
This guy man wey wear blue shirt make call and him dey tell the person wey him call ( Ali) to prepare him better indomie and egg #500 that he is own his way coming, Make him no waste time coz him get plenty work to do and hunger dey wire him .
Na so uncle blue shirt don dey salivate inside this bus , him even tell driver to speed up .
Conductor tellam say make him cool down say no be only him dey hungry inside this bus . Uncle blue shirt just look conductor and tellam to mind his business.
One woman wey siddan for back shout make driver slow down small . Conductor ask her wetin happen , na him she talk say she want buy akara and bread coz she sef dey hungry .
Which kind Wahala be this , una no eat for una houses. The guy wey siddan with me shout in anger . I kuku exclaim myself ” I wonder o ”
Driver just dey peep us from his mirror , me I don know say him want play us dirty game coz him just dey laff as people dey shout inside bus say dem hungry.
We don reach for one place like that , e get one woman wey dey sell rice there. Driver stop bus , him and his conductor come down , dem say hungry dey wire dem too make dem go chop first .
People start to para inside the bus , na him conductor talk say ” if anybody wey want vex, make him go hug transformer ”
Wo Las Las , me sef , I buy bread and mineral eat inside bus make e no come be like say hungry no catch me too. All of us inside that bus dey hungry but some of us dey form .
As I dey chop, I dey listen to music and be nodding my head like agama lizard wey just fall from tree top.
Danfo Wahala
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}