Danfo wahala - S01 E10

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E10

Read Story: SEASON 1 EPISODE 10

So e happen that bus wey I enter , driver don loud his radio set to the extent that we wey siddan for back sef if we shout Conductor “owa o ” dem no go even hear . Na news dem dey talk for the radio station with all the bad bad news wey dey this country . E come reach when dem start to talk about Covid 19 and how the thing still dey outside , how we need to prevent it and protect ourselves.

So e get this guy inside this bus who has been coughing , na only him sabi wetin him chop wey dey choke him . Abi toothpick don block his throat ? Anyways e no consan me sef jor .

So as them still dey talk about Covid 19 and how we need to avoid coughing publicly , na so everybody inside this bus start to look at the guy but broda cough no even send anybody.

Wo! Why una dey look me like thief , she una want call NCDC make dem come carry me , abi person no fit cough in peace again ? Broda cough replied angrily.

Me wey dey from back ,I kuku reply say ” oga wear your nose mask jor , abi you chop lion meat ” people start to talk say na true make him wear his nose mask .

The girl wey siddan near him don fear finish, she no know wetin she go do to comot from that seat .

At a point ,one guy start to laff inside bus and he was asking why we dey fear coz Nigérians sef no believe that Corona virus is real .

Broda cough finally stop coughing and him talk say na thunder go fire everybody wey drag him when he was coughing. One woman be want talk back at him and guy man just tell her to mind her business and he told driver to stop make him come down .

Anyways, when him dey cough me I don wear my nose mask since , listening to music and nodding my head like agama lizard wey fall from tree top coz I no get strength for anything danfo wahala.

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E09

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E11

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
The alpha’s omega mate - S01 E15
Story | 1 day ago

The alpha’s omega mate - S01 E15

The alpha’s omega mate - S01 E14
Story | 1 day ago

The alpha’s omega mate - S01 E14

The alpha’s omega mate - S01 E13
Story | 1 day ago

The alpha’s omega mate - S01 E13

The alpha’s omega mate - S01 E12
Story | 1 day ago

The alpha’s omega mate - S01 E12