Danfo wahala - S01 E09

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E09

Read Story: SEASON 1 EPISODE 9

So e happen that this girl wear bum short and T-shirt enter bus . Well, as per normal street wear , she was good in her dressing . She dey smell fine , that’s even why they guy wey siddan near her start to dey do like dog wey want chop bone . Na thunder go fire him shaa !

So auntie bum short lap dey show well well but she no send anybody coz for her nothing wrong in her dressing as per city girl wey she be . She just dey press her phone and she received one call, she tell the person that she dey road , is like her friends dey wait for her make them go beach to go have a good time .

Her perfume choke well well as e don spread all over the bus , e come oppress my own perfume sef , na that time wey I know say perfume get levels . Poor me , wey think say my perfume even strong sef .

Meanwhile , I no know wetin happen but is like brother dog mistakenly touch her lap , na so auntie bum short givam slap inside bus o . Oboy, the thing shock everybody o , she come dey para why the guy go touch her for lap .

Mumu guy don collect slap , him no even get mouth to talk sef .

Driver just dey peep from his mirror like pikin wey want thief meet from his mama pot . Conductor troway face , him no even do as if something consan him.

One baba wey dey inside the bus ask auntie bum short why she go wear that kind clothes dey Waka for public. Auntie bum short talk say nothing wrong with her clothes say na street wear , make them no dey feel say anybody wey wear this kind clothe na bad person , she say she dey go beach with her friends. Na him baba tellam say why she no put the clothes for bag and when she reach the beach she wear am there . Sister bum short no like wetin baba dey talk, she come tell baba say make him go look after his own children and leave her alone . Baba be want shout for her , na him she tell baba say she go change am for him and nothing go happen if him talk anyhow to her . Baba jejely calm down, make him no disgrace himself.

Meanwhile brother dog eyes don red, is like that slap touch his brain shaa. Me I kuku know from beginning that thunder go fire him.

Anyways, I siddan me for back dey listen to music and nodding my head like agama lizard wey just fall from tree top coz I no get strength for all this danfo wahala.

??????????

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E08

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E10

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
The alpha’s omega mate - S01 E15
Story | 20 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E15

The alpha’s omega mate - S01 E14
Story | 20 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E14

The alpha’s omega mate - S01 E13
Story | 21 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E13

The alpha’s omega mate - S01 E12
Story | 21 hours ago

The alpha’s omega mate - S01 E12