Danfo wahala - S01 E08

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E08

Read Story: SEASON 1 EPISODE 8

E get as something go happen to you in public, you go just keep quiet and swallow the embarrassing moment like person wey dey swallow Eba.

Na so I dey wait for bus stop, bus scarce well well and passengers no too dey sef . After waiting for a very long time , me don tire for waiting sef , one bus come. As I call where I dey go, conductor say make I come, as I dey waka fast to go meet am cuz the bus no really stop, driver just slow down , is like him no want make agbero come disturb him, na so conductor dey shout make I run. Me wey don tire sef o .

So as I reach, make I enter the bus wey still dey move small small, I still dey tell driver make him wait nah, that one no even hear me. Meanwhile conductor don shift for me to enter because him siddan for that small seat, as I put my leg to enter , na so me and conductor hit head together, I feel like Boko Haram don explode bomb inside my head . Chineke ??? , conductor, which kind coconut head you get like this ? if you hear the sound eh??? e be like bomb. I first of all touch my head well well to make sure say this coconut head conductor no injure me . I take like 10 minutes rob my head, na so passengers dey tell me and conductor sorry but I know some of dem wan laugh. E get one guy wey dey look me and him want laff, if to say him try laff, na slap I go givam straight up.

Abi if driver stop this bus make I enter normal normal , all this thing for no happen….make conductor come collect money make I see .

Wo ! me I no even get time to listen to music jor , back seat wey I dey always siddan don full sef , my head just dey pain me gan , no joy at all.

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E07

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E09

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
The Daring Naughty Sleepover - S01 E39
Story | 4 hours ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E39

The Daring Naughty Sleepover - S01 E38
Story | 4 hours ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E38

The Daring Naughty Sleepover - S01 E37
Story | 4 hours ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E37

The Daring Naughty Sleepover - S01 E36
Story | 5 hours ago

The Daring Naughty Sleepover - S01 E36