Danfo wahala - S01 E04

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E04

Read Story: SEASON 1 EPISODE 4

Conductor dey find passengers make the bus full so that driver go move, me I don enter go siddan for back, dey listen to some music from my phone .

One beggar come around the bus to see if person fit dash him money . The man wey siddan for front seat be want give him money but na 1k dey his hand , him no get change coz he wanted to give the beggar 100 Naira.

” How we go take do am now , I wan give you 100 Naira but I no get change and I need money coz the place wey I dey go still dey far “. The man said to the beggar calmly !

” Boss ,no worry give me the 1k I go give you change ” The beggar replied.

So him come givam the 1k make him givam 900 change . The beggar put hand for pocket bring out plenty money wey even pass 5k sef . He find change inside the plenty money give the man .

The man shock , infact him surprise say beggar wey him give money even hold plenty money pass him sef ?.

Danfo Wahala

Danfo wahala

So e happen that the bus wey I enter go pass road wey heavy go slow dey.

Conductor been dey tell driver make him no pass that road coz somebody tellam say go slow dey there but driver with his big head like pumpkin no want hear wetin his conductor tellam.

Driver pumpkin head don carry us go enter go slow, no way to go back, no way to go front .

For my mind , I just dey laff and pity one man wey wear suit and tie inside this bus . Baba don dey sweat like meat wey dey inside frying pan ontop of fire . Baba just dey form as if him dey confortable whereas him don choke inside this bus wey dey hot like hell fire .

Conductor don come down start to waka dey go front , guy man don tire to siddan inside bus .

One guy blow one big lie inside bus wey make everybody shock . His phone ring and the person wey call ask him where him dey, instead of telling the person wey call him that he is inside bus, he told the person that him dey ontop of okada , that he will reach in the next five minutes.

One girl wey siddan for back shout “Lori iro ” when she hear the lie of the guy , na him the guy reply to the girl that ” Lori Iro ” kill you there !!

Thank God for gala and mineral sellers, I kuku buy one fanta take step down the heat wey dey do me inside bus , the girl wey siddan beside me dey look me as if she dey expect make I buy her own too. Oboy, I troway my face for outside o, I start to count cars wey dey inside bus stop . She jejely understand that local man is not interested.

Since wey conductor go, him never come back , na so passengers dey ask driver where his conductor dey coz he suppose give people change o. Driver tell them to relax say conductor don go check how road dey for front. As driver dey talk, na so conductor dey come, pouring one sachet of pure water for his head like person wey never baff since two days , well maybe na the sun don affect his brain shaa.

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E03

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E05

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
Thanksgiving In Reverse - S01  E01
Story | 53 mins ago

Thanksgiving In Reverse - S01 E01

My last wish - S01 E30
Story | 3 hours ago

My last wish - S01 E30

My last wish - S01 E29
Story | 3 hours ago

My last wish - S01 E29

My last wish - S01 E28
Story | 4 hours ago

My last wish - S01 E28