Danfo wahala - S01 E03

Story 2 years ago

Danfo wahala - S01 E03

Read Story: SEASON 1 EPISODE 3

Danfo wahala

I enter bus go siddan for my normal back seat start to listen to music.

Bus don full, driver start to move .. Conductor start to collect money , na there wahala start o .

First pesin givam 1000 Naira , him no talk anything. Another pesin givam 500Naira , him no still talk anything but I notice say his face start to dey frown like pesin wey want shit .

Another pesin givam 1000Naira , na there him shout ” Oloun, which kind wahala be this “? Wo, I no get change o , why una no enter with change ? Conductor halla inside bus, I even sure say his saliva touch that guy wey siddan near door coz as Conductor dey talk and shout with his crack voice, the guy just dey wipe his face with the handkerchief wey dey his hand .

Another pesin give conductor 500 Naira, Conductor come maad . Him start to dey para.

Passengers change am for him base on say him no tell anybody say him no get change .

As him stretch hand reach my side to collect my own money, I givam the 1000Naira wey dey my hand , him come look me like say him want beat me . Oboy me I no get strength to shout o, I troway face , balance well dey listen to music .

We don reach bus stop, conductor don join us , make we kuku go find change by ourselves ???

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E02

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E04

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
Buying My Step Sister - S01 E14
Story | 2 days ago

Buying My Step Sister - S01 E14

Buying My Step Sister - S01 E13
Story | 2 days ago

Buying My Step Sister - S01 E13

Buying My Step Sister - S01 E12
Story | 2 days ago

Buying My Step Sister - S01 E12

Buying My Step Sister - S01 E11
Story | 2 days ago

Buying My Step Sister - S01 E11