Read Story: SEASON 1 EPISODE 2
Wo ! Me I no fit help driver wey no get conductor collect passengers money again o for this life .
So e happen say I enter one bus wey conductor no dey . As we dey go, driver say make person help him start to collect money from back .
Oboy, I troway face for outside start to dey look at buildings and counting Lagos bridges .
One gentle man wey siddan near me volunteer himself and started collecting money . I givam my own money still troway face coz my mind don tel me say kasala go burst .
People dey come down from the bus , people dey enter and broda volunteer still dey collect money . Las Las na so guy man take see part time conductor job inside bus o , anyways e no consan me . He is doing well .
We reach last bus stop, broda volunteer give conductor money and after plus and minus , driver say his money no complete . Broda volunteer gats defend himself and convince driver that his money complete, driver sef face no get joy , he just dey shout as if he want to swallow broda volunteer.
Some passengers wey dey inside bus try to defend broda volunteer but driver don craze already.
Wo ! Me I can’t fit shout o, I jejely come down from the bus , put my earpiece, loud the music and Waka my way coz I no get strength for all this kind wahala.
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}