Read Story: SEASON 1 EPISODE 1
E get somethings wey when you see, e better make you no talk coz if you talk you go collect.
Me wey siddan for back , I dey surprise to see this fine girl and fine boy dey argue and drag each other inside bus , both of them be shouting and reacting like angry birds .
Inside bus, me I don learn my lessons , I just siddan for back dey observe them though I dey very surprised o coz I no understand wetin dey make dem para to each other like this , moreover na public bus be this . Well I make sure say, I low the volume of my phone, na so I remove one earpiece, make I fit to dey hear small small wetin dem dey talk.
Everybody dey mind their business while angry birds still dey para for each other . One man wey siddan near angry bird, him do face like kangaroo come vex too and started to shout back at angry birds , telling them to shut up or him go change am for them. Angry birds teamed up and started shouting back at uncle kangaroo. So now, the wahala don become angry bird versus uncle kangaroo.
At one point, uncle kangaroo be want talk back but him mistakenly spit saliva for the face of one yellow girl wey get eyes like pussycat .
Auntie Pussycat, change am for uncle kangaroo without wasting time .
Mad like everybody inside this bus don dey shout for each other o. Conductor sef dey drag #50 change with one guy wey ressemble shatta bandle .
Noise Inside bus loud like when children dey shout up NEPA. As our bus dey go, na so people go dey look our bus to know why people inside the bus dey shout like goats wey dem tie thick rope for neck.
Vrooooom suuiiiip ……..! Driver apply break heavily and shouted at everybody in the bus , una dey maaaadd ? Oya make everybody come down ,I no go again .
Passengers wan beg driver make him start bus but driver say him no go again , he told conductor to give back everybody his money .
Wo…..! ,Must I always enter bus wey wahala dey ? Anyways, I jejely come down , put my earpiece, loud the music and Waka.
Danfo Wahala
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}