Read Story: SEASON 1 EPISODE 84
He quickly stood up with speed looking dazed, I come dey wonder wetin dey happen.
Victory: Tara! he mutter
Me: Tara kill you there, shebi her gorilla boyfriend don warn you. Is like you wan die.
I hissed and walked away, I browse enter parlour where we dey keep broom.
I started sweeping from our room enter the hallway then kitchen, go parlour then park am for the frontage.
After I was done with sweeping I enter mopping, I stared at my phone and saw the light on.
I come pick am come see four missed calls from Anita, I come dey wonder if I put my phone for silent.
But I no put am, another call enter terminate again from Anita, I nofit vex. This girl get F9 for calling and A1 for flashing, I hissed and called afterall she go fit come give me one or two when I need am.
Me: I change accent hello sugar for life.
Anita’s voice: good morning.
Me: morning oh! you nodey go school today?
Anita’s voice: she giggle today na Sunday.
Me: oh! I mean Church.
Anita’s voice: I wan go second service.
Me: pray for me too oh!
Anita’s voice: you no go go?
Me: I don go yesterday.
I lie before one girl go drag me go Church wey me sef never ready to go Church.
Anita’s voice: you be Adventist?
Me: yes.
Anita’s voice: later.
I be wan ask am wetin she mean by later she just terminate the call, I come dey waooh because na me call her oh!
I took my bath and changed to something better, that morning I decided to fry potato and drink akamu.
I waka come out but the stores around our street no open.
So I head go the street along the Anglican Church that leads to the express road wey own age don die with the word tarred.
When I reach there some Aboki wey dey sell potato dey with their wheelbarrow, I waka go meet one.
Me: Aboki, give me potato two hundred naira own.
He started picking it and I was disappointed, I think say em go put plenty. This North people wan even exploit us for marketing too.
Me: I no wan buy again.
Aboki: buy am for me, I go put am well for you.
I nodded and he behaved, see the way the guy for cheat me.
I took the bag and headed home, something made me look back and I saw Chisom with some guys approaching behind.
I turned and behaved like say I no see them, immediately waved and stopped one keke and hopped in.
Their three started chasing me, see the way I waste fifty naira because of that mumu girl.
I dropped at the Anglican Church and paid fifty naira, I took off immediately.
Panting heavily, I just corner enter my road.
I jam Anita and one fine girl like that, the girl yansh senior Anita own.
Anita: Grace, see my boyfriend.
I be wan slap Anita for vomiting such nonsense, boyfriend or no boyfriend that yansh must be tested.
Me: Ani, you nodey go Church again.
Grace: so, you be Anita boyfriend?
See Jamb question.
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}