My WhatsApp Visitor - S01 E68

Story 3 years ago

My WhatsApp Visitor - S01 E68

Read Story: SEASON 1 EPISODE 68

I be wan answer her say I no be pastor when my phone started ringing, I checked the caller and it was Chisom, my heart skip.

Me: no vex, my pick this call. I dey kitchen.

Oniobong: all these small small chew gum girls don dey call you again.

I nofit hold the laugh I swear, I closed the door and started laughing as I head to the kitchen. My ringing tone was about to end when I swiped the screen and picked the call, wetin Oniobong talk still dey replay for my head.

Chisom: why you dey laugh?

Me: no vex abeg.. Person tell me something wey make me laugh.

Chisom: you wicked oh, so you don collect wetin you want na.. You no care about me again.

Me: baby, I don’t understand.

Chisom: since wey you fu-ck me, when last you call or chat me up?

Me: I dey sorry na, you know say I dey go work.

Chisom: you no try oh!

Me: sweetheart, the girl I go die for.. My one in a million.

Chisom: commot joor, Vic, I need your help.

Me: anything for my baby?

Chisom: you sure?

Me: ah ah! Anything for you, you no trust me again?

Chisom: I trust you, love of my life I smile na hospital I dey like this?

Me: wetin you go do for hospital?

Chisom: my mama, them call me say she dey hospital.

Me: eyaaa! sorry oh, how she dey?

Chisom: she nodey fine she start crying you fit borrow me fifty thousand naira?

I went deaf immediately, fifty wetin? Where I go see that kind money? na all these plenty questions I just dey ask myself oh.

Even though I wan scam my papa, em no go even gree release fifty thousand naira.

Me: Chisom, abeg end the call come online for whatsapp.

I switched on my data and I took a matches, and lit the burner then placed the pot I poured water into on the fire.

Chisom message pop-up on the notification bar.

Chisom: you no go help me?

Me: na em make I ask you to come online.

Chisom: I no get any other person, na only me my mama born. Please, Vic all those people wey dey f--k you nkor?

Me: I for help you oh, I nodey work for any company oh.. I never even finish school.

Chisom: what are you saying na?

Me: I no even get 50k for my savings account.

Chisom: tell me you are lying.

Me: am serious, all the company work something na just lie.

She viewed my message and didn’t reply fast like before, I dropped my phone first and continued cooking the indomie.

I put the noodles and spiced it up with crayfish and vegetable leaves with eggs, then finished cooking it.

I placed a frying pan on the fire after mixing egg with small salt and maggi, then with fresh paper. Poured inside the heated grand oil on the frying pan, my phone started vibrating non stop. I come dey wonder who love me like that na? To bomb me with so many messages.

After I was done putting the toasted egg on a breakable plate, I wiped my hands and picked my phone. I opened the message and all the vibration message notifications was from Chisom.

I opened it and saw thousand curses, my phone started ringing and it was Chisom. I picked it.

Chisom: God go punish you for all the lies you dey take deceive girls.

Me: wetin bring that one?

Chisom: idiot, useless boy.. Your p---k no go ever stand again till you die.

Me: Chisom, why you dey insult me?

Chisom: if I no f--k you up for this Port-Harcourt wey we dey, change my name from Chisom.

Previous Episode

My WhatsApp Visitor - S01 E67

Next Episode

My WhatsApp Visitor - S01 E69

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
A Mother
Story | 1 day ago

A Mother's Seduction - S01 E04

A Mother
Story | 1 day ago

A Mother's Seduction - S01 E03

A Mother
Story | 1 day ago

A Mother's Seduction - S01 E02

A Mother
Story | 1 day ago

A Mother's Seduction - S01 E01