Read Story: SEASON 1 EPISODE 58
Oniobong: sister kwa, ona two come dey waka for road as lovers.
Me: see you, na my sister.
Oniobong: hmmm… That kind sister.
Me: when you go visit me na? we live close to each other oh.
Oniobong: small boy like you, wetin I wan come do for your house?
Me: I be small but mighty oh, iffa handle you for bed ehnn..
Oniobong: chuckle na wa oh! sha… no worry.
Me: so you go come?
Oniobong: okay oh, I don hear you.. Later abeg.
She started joggling away, her yansh rumbling on the tight sports trouser, the girl yansh big die. Wetin spoil am be say she no tall, but bre-asts and bumbum she carry am.
I went home and met my twin brother in the kitchen preparing rice, my phone started ringing and I brought it out. Gosh! Na so Soapy oh!
Me: my baby boo for life.
Soapy: just stop it … Where are you?
Me: I dey house.
Soapy: come and meet me in Pepperoni now!
Me: babe, I no hold money na, tomorrow we fit go there.
Soapy: no, am waiting for you there now, start coming.
She ended the call, I no get choice but to enter bathroom took my bath and quickly dressed up, even before I came out of the bathroom she don knack four missed calls. The babe no get joy at all.
I entered keke for the Anglican church go St. John’s, when I reached St. John’s she called me again.
I just pick.
Me: I dey come, I dey st John’s na.
Soapy: raise your hand up.
Me: I raise my right hand up you dey see me?
Soapy: yes, worwor boy.
She ended the call and a very beautiful girl came out of a shop beside the road, the babe clean fah.. Chiaa! Camera dey deceive me, I swear.
Soapy: big head, so you are that whatsapp bad boy?
Me: give me hug first na.
Soapy: I no go even try am, come show me your house
The babe too fine I swear, see the way niggas dey ask me if she be my sister ehnn.. So that them go try their luck, ordinarily I nofit waka go meet her for road dey preach love na, her skin don tear our world apart.
A call entered her phone and she picked…
Soapy: young man, stop disturbing me.
And she ended the call, the guy wey sit down beside me for the keke just dey look the Soapy and look me. Em dey wonder how manage, make thunder strike, as if say I no fine.
Sha… The only thing wey remain na money na, the way the keke come dey dance skelewu since the road no good na, I just dey watch her Soapy bre-asts dey jiggle for the vex she wear, she wear one fine jacket to cover wetin I don see.
We came down from the keke, I just dey look her… The babe too fine, I swear.
Soapy: why you dey look me like that?
Me: nothing oh.
She smiled and her white teeth shocked me, close up advertisement candidate. I just dey feel my new rise rank as we dey waka go my house, when devil wan show you pepper ehnn… You no go even know how em go take do am.
Oniobong just appeared for our house road, wey we wan enter. Babe wey I dey fine to sample her big yansh oh.. She just see me dey smile.
Oniobong: you this boy.
Me: good afternoon.
Soapy just dey observe us sha… She know say I love puna.
Oniobong: this one na your sister too?
Me: no!
She waka go while me and Soapy go our own.
Soapy: you don fu-ck that babe?
Me: no, naso fu-ck easy?
Soapy: dey there na..
Some girls ehnn… If them be boy, them go be wicked womanizer, I swear.
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}