Adventures Of Deji - S01 E10

Story 3 years ago

Adventures Of Deji - S01 E10

Read Story: SEASON 1 EPISODE 10

As Deji and Junior consume the local made indomie they chat along.

Deji: oh boy how your babe na?

Junior: guy abeg forget that stuff joor.

Deji: wetin you mean abi una no they together again?

Junior: not really, i just say make i bone her since she wan run me dry.

Deji: oh boy those girls no get Joy at all oh.

Junior: you go fear fear na.

Deji: hmmm e get one babe for this compound wey i talk to just now.

Junior: ha Deji, you just come today you don begin show your characteristics.

Deji: hahaha you nor say me nor fit stay without babe na.

Junior: wetin be her name self?

Deji: she say na shalom (Junior wanted to take a chump but when he

heard the name he pause and look at me).

Junior: hmmmmm.

Deji: wetin happen Junior.

Junior: na police they shine her kongo oh.

Deji: really?

Junior: yes na, that man don arrest three contestant for her head.

Deji: ha this one strong well well oh.

Junior: yes na, na him they take care of the girl self and that room wey him they na the policeman rent am for am.

Deji: why him no just better marry her?

Junior: for where the man wey get wife and four children for house.

Deji: like seriously?

Junior: yes na the man na family man him just they use this babe do collabo.

Deji: chai some girls they mumu sha but no qualms sha na hit and run i wan do.

Junior: na you sabi oh if you enter Jail i go deny you oh.

Deji: forget no they fear joor, how you wan make i ignore that ass?

Junior: na true you talk sha that babe set for back no be small.

Deji: so you too they take note.

Junior: yes oh but the fear of those black guys make me stay my lane oh.

Deji: so you nor just fit hit her once?

Junior: na only teeth one guy shine for her wey the idiot police man arrest am.

Deji: hahahaha that man na idiot.

Junior: you never see anything just let am catch you then you go know who be the real idiot.

Deji: oh boy you don make me fear small oh.

Junior: well you still fit hit her because some guys still they hide gbog her.

Deji: hmmmmm.

As they were discussing Deji phone started ringing, he look at the screen and saw Madam.

“chai na why madam lily they call me now” Deji thought.

Previous Episode

Adventures Of Deji - S01 E09

Next Episode

Adventures Of Deji - S01 E11

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
Invincible - S01 E3015
Story | 10 hours ago

Invincible - S01 E3015

Invincible - S01 E3014
Story | 10 hours ago

Invincible - S01 E3014

Invincible - S01 E3013
Story | 10 hours ago

Invincible - S01 E3013

Invincible - S01 E3012
Story | 10 hours ago

Invincible - S01 E3012