Legendary Toto - S01 E15 (Story Episode)

Story 3 years ago

Legendary Toto - S01 E15 (Story Episode)

Read Story: SEASON 1 EPISODE 15

Subtitle – please share abeg..

Shade:[forming queen kong] despite the fact say I love una, una still dey follow Toto anyhow, shey Queen matter never do you??

Tho I felt guilty, but I won’t just let her insult me laikdat.

Me:[frowned, still holding my cheeks] wetin dah one mean??
Coz I allow you come here no mean say you go dey harras me anyhow [standing up]

Vicky:[clapping her hands] una still dey talk bah??


E be like say the slap wey I tear una never reset una brain??

I quickly shut up, I don know Vicky tey tey as a street fighter, infact her fighting skill is natural.


Buh you see Shade ehnn??
Her fighting skills is proudly sponsored by pulling d*cks..


Aahh the day Shade pulled my di*ck na dah day I know why Lazarus betrayed Jesus.


The day I offend her laikdis she no waste time na my di*ck she fess pull.


Since dah day ehnn, whenever I knew she’s aiming for my crotch area I’ll quickly protect it with my hands I yaff nor born abeg..

Vicky: emm no know, than to dey tear any toto wey emm see, rubbish. if them born una mama well mai see you put dah thing inside any hole again

Na dah her statement make me vex oo, dah small words

Me: come una dey craze nii abi wetin??


Oya the two of una comot for my room na na.

Vicky: una still de…

Me:[yelled] I say get out!

The both of them were frightened and suprised, I knew that coz of their facial expression…


They juss jejely carry themselves out.

I quickly arranged my room and went into the bathroom and have my bath, dah slap wey Shade gimme too much, my cheek juss dey vibrate by emm seff.

I wore a new pair of cloth and went into my kitchen to meet my food well served at least she don cook before the Mayweather spirit enter em body.


I tossed a stool to my front and placed the food on it I was about to about to give the food the beating of its life when I heard people shouting and hailing someone outside I wan go look buh when I remember the Legendary incident I kuku face my food the way I ate the food ehn you go think say I never chop for hundred years.
I finished the food and washed it I was about to lie down when I heard Vicky’s name I quickly stood up and went out.


And behold Shade and Vicky dey thrash themselves.

Emeka too much money: yeah yeah! I trust you Vicky baby beat the stranger, she came to play an away game I’m going to spray you money

I just watch as the idiot dey speak fune, wey eemm generation no teach am.

Corper Florish: Abeg no kill am naw, Vickyyyyy ooo

Ngozi: so Vicky fit fight laikdis

Mama tope: ahhhhhh thank God say I quickly come house today I for no watch this life match

Papa Anderson: Yeah yeah it’s Vicky FC and Stranger FC .


YEAH YEAH Vicky FC is leading

Ngozi: mama Tope mai see the match clearly naw!!

Mama Tope: una no get respect?? na me you dey follow talk laidat??

Ngozi: wetin you wan do??

Naso dem start their own mortal Kombat season 2

Infact the compound don turn to cinema even people wey dey down the street seff come watch showdown.

I quickly separated Shade and Vicky.

Shade: you come tell me say make we bone face for my boyfriend you come dey tell me say you love emm amadioha strike you there.

Vicky: tarrrh! ooooo so you think say I dey joke when I tell una say I go show you pepper una never see something oo.

Buh wait ooo if Dem plan say dey wan bone face for me make them land me for hospital why Dem dey fight when I reach house??

Well dah one na their problem I separated them before Shade left but not with threats Vicky too left for her room before everyone started leaving.

I went in and took my wallet, am running out of cash, so I went to the bet9ja shop.


I hail my niggas as usual before I go carry game.


Luck shine on me when I carried the first game, second and third game.


MEHN result cane out I won everything I went there with just 500naira and I’m having almost 30k in my wallet
My niggas have started hailing my I don dey feel fly.


Untill when a stupid friend of mine say my come carry live matches I see that as an opportunity to make more cash coz their odds dey good.


The first match finish, boom I loose 1k another match finish I look another 1k.


I loose almost all the money I won, 30k don remain 5k and those stupid niggas of mine still dey tell me say make I samah dem 2k.


I quickly find my way home before them go spoil market for me.

I got home and walked to my door only to see some figures standing before my door.
I walked closer to them and saw them.


Na Legendary and his crew.

Legendary:[smiled] hmmmm teacher, teacher…

Previous Episode

Legendary Toto - S01 E14 (Story Episode)

Next Episode

Legendary Toto - S01 E16 (Story Episode)

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01  E02
Story | 1 day ago

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E02

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01  E01
Story | 1 day ago

Ty & Cinda, A Tale of Forbidden Love - S01 E01

The Wanted Virgin - S01 E100
Story | 1 day ago

The Wanted Virgin - S01 E100

The Wanted Virgin - S01 E99
Story | 1 day ago

The Wanted Virgin - S01 E99