Adanna - S01 E16 (Story Episode)

Story 4 years ago

Adanna - S01 E16 (Story Episode)

Read Story: SEASON 1 EPISODE 16

I was on my way home, when i branch at one supermarket i ask how much for catton of indomie they said two thousand four hundred naira, i went home and check my wallet, money no dey, na which kind wahala be this na eh, i put a call to my loving elder sister.


Sister B: hello


me: good evening ma


sis B: how you dey


me: i dey manage


sis B: na manage you dey always dey manage, you nor dey satisfy


me: hahaha when i finish school then i go satisfy.


Sis B: so wetin you want this time.


Me: na just small change.


Sis B: wetin una wan use am do.


Me: we dey go for excursion and e dey compulsory for everybody because if we nor go, we nor go fit report am.


Sis B: yes na true, na im make you be science student, na how much


me: na only eight thousand naira


sis B: okay tomorow na sunday i go send am for you on monday.


Me: thats my loving sis.


Sis B: only when money is involve abi?


Me: haa no oh, you nor say na you be my second mother.


Sis B: na u sabi, i hope those girls no dey disturb you for there sha.


Me: no i still be virgin na, or you nor trust me again?


Sis B: why not, you better remain virgin because after school na me go find woman marry for you.


Me: and i hope you don dey find down.


Sis B: no oh i dey wait make you finish first.


Me: okay no problem i hope the girl go fine like genevieve.


Sis B: no be about fine na about character, i think say i don tell you before, the beauty of a woman is inside not outside she said.


Me: okay i don hear bye bye make i do assignment.


I cut the call, truly no be about fine sha, if say na by beauty lara for nor gree marry oshiomhole na, but na because of money lara marry oshiomhole, so any one wey she find for me, if e nor fine she must get pepper.


I took my wallet and head to first band opposite MCC road there, i reach there omo see que, the que long reach road sotey them come bend like snake, upon all say na 6 atm matchine dey there oh ( i hear say them don do three join), i waited for my turn, while waiting i receive a call from adanna.


Me; hello hurney


adanna: how are you durley


me: am fine.


Adanna: were are you that place look noisy.


Me: yeah am at first bank, trying to withdraw some money.


Adanna: what do you need money for?


Me: just to buy catton of indomie


adanna: i see no problem, please go home when you finish in bank, when i come visit you we will go and buy the indomie together.


Me: yes my love.


Adanna: alright see you then bye.


Me: alright take care.


I withdraw 2k remaining 1k for my account, i went home direct, to wait for adanna, when i get home, i saw the padlock of my door open, i open the door and went in and there lay the charming angel with two catton of indomie on the floor.

I open my door and the mysterious lady was sitting on my bed mysteriously with two mysterious catton of indomie on the floor, she wore a short skirt abi mini skirt, and a white handless shirt, i walk in majestically like a gentleman.

Adanna: hello durling (she said standing up to meet me) how are you.


me: am alright, i dont need to ask you how you got my key, but why didnt you tell me you bought the indomie already (at least i for no go withdraw that small change wey dey for pocket na)


Adanna: well i wanted to surprise you. (she said, giving me a peculiar kiss)


Me: and you did a hell of a job, thanks alot dear ( i said settling down on the bed with her)


Adanna: o come on you dont need to thank me, if i dont take care of you who will? (according to ritababe).


Me: thats why am the luckiest man in the world and am lucky to have you.


She smiled as we sat down together on my bed, no light for house chai gbege ( and the one wey she dress come like this something must happen oh, and my room wey dey hot like hellfire when no light, she brought hollandio yoghurt from her bag and bread, we started eating and discussing.


Me: i thought you dont eat those type of foor.


Adanna: and what do you think i eat?


Me: well maybe human blood or flessh
she laugh out loud, oh god i so much love seeing her laugh with her sparking teeth like diamond


Adanna: well you are right but am not some kind of vampire or cannibal, but those food am eating mean nothing to me, i just consume them to balance your satisfaction, my real food is live meat.


Me: live human? (getting scared as if if she want eat me she for never eat me since)


Adanna: yeah i mean like live rat, frog and others.


Me: others like wat


Adanna: like human.


I was putting food in my mouth when she mention human i paused like somebody wey im mama catch dey thief meat for pot like cherrybrown ;D


Adanna: come on i was just pulling your leg, i dont eat human, if i do those guys that attack you that, that body would not have been found.


Me: what you did was hilarious ( i said calming down).


Adanna: yeah i know and i dont regret it, something would have happen to you if i didnt stop them.


Me: but chinansa is wicked oh, by the way its been long since i saw her, i think she travel.


Adanna: yeah, she travel and you will never see her again, she said bowing her head in a sorrowful way.

Previous Episode

Adanna - S01 E15 (Story Episode)

Next Episode

Adanna - S01 E17 (Story Episode)

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
Jeffry And Billy - S01 E14
Story | 9 hours ago

Jeffry And Billy - S01 E14

Jeffry And Billy - S01 E13
Story | 9 hours ago

Jeffry And Billy - S01 E13

Jeffry And Billy - S01 E12
Story | 9 hours ago

Jeffry And Billy - S01 E12

My last wish - S01 E59
Story | 17 hours ago

My last wish - S01 E59