Twins Adventure - S01 E09 (Story Episode)

Story 4 years ago

Twins Adventure - S01 E09 (Story Episode)

Read Story: SEASON 1 EPISODE 9

A house divided against itself cannot stand.


By : Abraham Lincoln

Favor : see una, assume I nor rush come here una nor go fit wait for me abi.

Oyibo :(undisturbed) na you sabi.

She quickly rushed to a corner of the room and picked a spoon and joined them in eating. After they have all finished eating they all sat down at different sides with joy on the bed.

Favor: (to oyibo) She won stay with us.

Oyibo ; jamb question abi u nor dey see new bag for here.

Favor : u too get hot temper.

Favor : (to joy) My name’s favor, what’s yours?

Joy: Joy .

Favor : OK joy welcome to our little room, which side you come from.

Joy: From Ovurade.

Favor: I nor sabi the place, but how madam glow take find you.

Joy : Madam glow?

Oyibo : Yes na she nor tell you her name?

Joy: Na aunty glory I use know her, and she be my mother younger sis.

Favor /Oyibo : (surprised) Talk true?

Joy: (Alarmed) True, Wetin happen?

Oyibo ; (shaking her head) u go soon understand.


Favor : But that woman get heart o.

Oyibo : Sofri talk o I nor want problem, mah go prepare go work.

Favor : Long cue dey bathroom o

Oyibo : who wan bath for bathroom na outside I go bath.

Favor : ok o.

Oyibo : u nor dey go today?

Favor : No, today na my break.

Oyibo went out of the room to have her bath.

Joy : ehhm favor all of una wey dey here, na my aunty dey sponsor una for school.

Favor :(laughing) Girl u dull, as u fine reach u never start to piece one or two together. See mah tell u some of us wey dey here like me and oyibo don graduate from school since, while some of us still dey school , some self nor Carry anything like school for mind. But unto say we won butter our future bread na Im make we dey here.

Joy : I nor understand dey do Wetin for here?

Favor : they hustle na.

Joy :Which kind hustle?

Favor : Mah just tell u nw make u nor go dey look madam glory like mumu if she call you tomorrow. All of us wey dey here we be commercial sex workers, prostitutes aka confirm ashawos.

Joy :(astonished) ewoh, are you serious?

Favor : u dey ask me, mah let you know na join u come join us so as to move the ministry further.

Joy : God forbid I nor fit o

Favor : (laughing) u too funny, just because you say I nor fit madam glory go come leave. Mah let u know u see that woman she and devil dey work hand to hand, she nor get conscience .

Joy : Na my aunty she be she nor go fit do me that kind thing.

Previous Episode

Twins Adventure - S01 E08 (Story Episode)

Next Episode

Twins Adventure - S01 E10 (Story Episode)

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related Stories
Abigail - S01 E78
Story | 8 hours ago

Abigail - S01 E78

Abigail - S01 E77
Story | 8 hours ago

Abigail - S01 E77

Abigail - S01 E76
Story | 8 hours ago

Abigail - S01 E76

Abigail - S01 E75
Story | 9 hours ago

Abigail - S01 E75