"Allow ads" and Popups to avoid redirection of your browsers.

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 18

Episode 6 years ago

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 18

"But guy you be goat ooh, how you go sell gold, the money wey you take sell am you no bring am come back!" Day six of Dornu's kidnap.

Guys were really on hideout; they all passed every night in Flo's spacious hideout room for the fear of God knows what aside Nnamdi that always sneaked into his room on returning from work everyday - He stopped talking to neighbours since the kidnap.

"Na you be Goat! You no know say them drug me! I swear them drug me"

"Who drug you? When dem go say make u dey come coke studio come take Egusi you no gree" Egusi was another name for coke.

"Guys shebi Nnamdi say him go buy us more shaks if him dey com this morning?" Ade reminded.

"Buy you more shaks? The one wey you drink yesterday night make you wan jonz for where my girl dey abi?" Ogbonta cautioned.

"I no do anything na, as your babe Dornu say she no well say she no fit baf, nahim i volunteer to baf her na"

"Chief bafer!! So na from n'yash dem dey start to baf person abi?" Ogbonta was furious.

"No ooh! Na she say her n'yash dey pain her say make i help her massage am na!"

"Chief massager! Na person babe n'yash you wan massage"


"Guy i hear say them police dey com Baba street dey look for us!"

"Eheen! Make them dey look for us na! Them no fit know say na here we dey" Ola said, "abeg bring shak make we shak jor!"



Meanwhile at the restaurant;

"Oga Flo why we dey pack na? Shey we no dey do business again?" Nas was surprised.

"Nas! Nas! Nas!! How many times i call you?" Flo was pissed.

"Oga! Oga! Oga!! How many times i answer you?" Nas so hated such questions.


"Oga wait for me make i finish to lock the shop!"

"Do quick!" Flo signaled from the Volk wagen car waiting.

"Wahun! Waaaaaa! Wahun! Waaaaaaahun!" Flo could hear police siren from market junction.

"Guy abeg drive this motor fast, we need to leave this Rumuigbo fast!" He said to the driver.

"Oga Flo wetin dey happen? Why we dey leave Rumuigbo?" Nas curiouly asked.

"Guy when we reach where we dey go you know why we dey leave" Flo answered.

"But oga i wan s'hit ooh! Heavy s'hit dey catch me"

"Nas you be big f'ool i don talk am! I dey tell you say town dey on fire you say you wan s'hit! Oya come down go s'hit na! Abi you wan s'hit inside this motor?"






"S'hit for my mouth na!" Ade said to Ola, "Abi you no know where toilet dey?"

Ola had barely shut the toilet door when;

"Toooookpooom! Tomooooooop!" Gun shot everywhere.

"Wetin be that? Na Knockout abi?" Ola wished "Yes" was the response

"No ooh! Na gun ooh!" Ogbonta could tell.

"Ghoooooog! Gvoooooh! Gbooooooh!" Ola's spirit left his body.

"Na Police oh! Dem don surround us!" Nnamdi saw from the window view.

"Gtooooooom! Gbotoooooooom! Gpaaaaaa! The gun shot was alphabetical and closer too.

Ola instantly slipped and stamped his face on the opened toilet sit; submerging his face on holy water- unflushed p'oo water.

"We are doomed!" Ade was on Dornu's a'rse. Her big a'rse was his Mouka foam and he was reasoning fine albeit the rest us under pressure except Ola who was under-water bubbling.

"Gbooooar! Gbooooooar! Gboooar!" We know you are there! Open the door!"

"Ogbo baba! Go open the door na!" Nnamdi mumured.

"You why you no go?"

"Open this door! You have been surrounded! You will all die!" One half baked police officer announced.

"You will all die die die die die die die!" Echoed in Ola's head as he chewed Vanilla favoured bubble gum and swallowed.

"We and breaking in in 30 seconds if you don't open!" Ola was now chewing Strawberry flavoured chewing gum.

Previous Episode

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 17

Next Episode

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 19

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)