"Allow ads" and Popups to avoid redirection of your browsers.

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 10

Episode 6 years ago

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 10

Ogbonta's kisses were memorable, highly romantic, out of the blues, mouth watering to talk less.

Those kisses were memorable and Dornu would never forget the cuddles too.

Handsome Ogbo baba nose-dived the relationship that would have lasted like diamond. Something caused it - Ali ndam.

In Ikwerre dialet Ali ndam means "My land"; and yes Ogbonta's land cost him his relationship with Dornubari his girlfriend.

Ogbonta owned 2 plots of land in Rumuekini, his land he so much cherished and adored. He had once promised to behead whoever tresspassed talk more of venturing to sell it.




"Oga make we call Ogbo baba tell am say dem don sell him land" Nas told his boss one Sunday morning as they walked pass Ogbonta's piece of land while returning from church.

"Yes we go call am! You no see wetin them write for the fence? dem write -This land is owen by Chief Emeka Eze, pleased keep ofor"

"Oga shey na Michael Owen get this
land?" Nas asked his boss while taking another look at the inscription on the fence.

"Them dey sell Ofor for here wey dem write - pleased to keep Ofor" Nas the illitrate.

"M'umu! No be wetin dem mean, dem no spell am well" Flo cursed.

"Oga i dey tell you wetin dem write here, na either Micheal Owen or Owen Gee nahim sell this land for Chief Emeka Eze Ofor" Nas professed.

"But who com be Owen Gee, Michael Owen and Emeka Eze Ofor?" Flo a graduate was instantly painted the emulsion of illiteracy Nas carried.

"Michael Owen dey play ball for Eyimba, Owen Gee na American Musician, Emeka Eze Ofor dey sell beans for Kano State" Nas brilliantly answered.

"Okay, i gree for all this people wey you talk so, but wetin i know be say make i call Ogbo baba tell am say dem don sell him land"


Meanwhile Ogbo baba was in church praying. His phone rang.

"Who be this mu'mu wey dey call me" Ogbonta put off his phone, "why is Flo disturbing me when i am discussing with my father"

"Hold your neighbour's hands, say neighbour! E no go better for the devil wey wan try me this year" The man of God announced..

"E no go better for..........................." Ola held Ogbonta's hand firmly.

"E no go better for.........................." Ola's phone rang.

"Ogbo! Ogbo! Flo dey call me!" He tapped Ogbonta mid-way the prayers.

"Ooh! Devil get behind me!" Ogbonta motioned.

"Na me be devil abi? I dey tell you say Flo dey call me you say devil get behind me!" He sneaked out.

"Hello! Flo wetin dey happen? We dey church call us back............ Ehnn? You say wetin? Dem don sell Ogbo baba land?................ Choi!"

"Say to your neighbour! You will dominate your land!" The man of God announced.

Just then Ola sneaked back in from outside saying, "Ogbo baba dem dom sell your land ooh!

"Ali ndam eeeeh!"

Previous Episode

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 9

Next Episode

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 11

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)