Must Read: Ibo Boy Wey Like Yoruba

Episode 6 years ago

Must Read: Ibo Boy Wey Like Yoruba

“Flow why u dey waka like dis, u break ur leg?” Ilorin asked as i walked into the compound that night. “nothing happen to me ooh, only be say i fall from bike, u don come back from Ilorin?” I said. “i don come back oh, Our LGI say him wan see me, him call me for phone nahim make me come back” Ilorin responded. “guy Hope say no Wahala? Bcos that our LGI na bad man oh, naso him hala me well well when i tell am say i wan apply for another NYSC ID card that time wey My NYSC ID card loss?”. “i don go see am, na him house i just dey come from now” Ilorin added. “wetin him talk na? bcos him been dey talk your case for CDS last week, hope say dem never give u service extention oh?” i asked. “go baf come, i go yan u everything” Ilorin responded.

I took my bath, and headed straight to Ilorin’s room. There was no way i would have slept in my room. No way. “oboy i no go follow una pass out next month oh, i don get service extention oh, LGI say him don forward letter go Abuja make dem extend my service year to another one year oh” Ilorin said as we both sat in his room eating. “oboy oh dat one na carry over be that oh” i said. “nahim make me dey vex na. Him say i go stay for Ilesa until Tola born the pekin. If she born finish, i go com marry her, if i no wan marry her i go carry my pekin go” Ilorin explained. “so dem no go give u ur discharge certificate until the girl born? Na una agreement be that?” i inquired. “na our agreement oh, naso the girl mama and Papa want am sef” Ilorin added.

The Ilorin i used to know is a completely different Ilorin, he had really lost so much weight. It was as if he was ill. The fun in him had suddenly fizzled out.

Ilorin was going through a traumatic experience likewise me. So it was all man for himself. He should carry his cross while i carry mine. But, my cross was sure heavier than his, or so i tot.

As i massaged my aching ankle with Ilorin’s Aboniki, i suddenly heard a noise outside. Just when we wanted no more troubles in our compound, trouble was already knocking.
“where Victor? Na u be Victor?” someone shouted outside, “no be me oh, e dey toilet” a voice that sounded like Sammy’s responded.

Previous Episode

Must Read: Ibo Boy Wey Like Yoruba

Next Episode

Must Read: Ibo Boy Wey Like Yoruba

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Black Spot S02E07 - Like a dog
episode | 4 years ago

Black Spot S02E07 - Like a dog

Watchmen S01E04 - If You Don’t Like My Story, Write Your Own
episode | 4 years ago

Watchmen S01E04 - If You Don’t Like My Story, Write Your Own

Bob Hearts S01E07 - Tough Like a Laundromat Washing Machine
episode | 4 years ago

Bob Hearts S01E07 - Tough Like a Laundromat Washing Machine

Kids Say the Darndest Things 2019 S01E05 - Marriage Seems Like a Huge Commitment
episode | 4 years ago

Kids Say the Darndest Things 2019 S01E05 - Marriage Seems Like a Huge Commitment