Must Read: Circle Of Three - Season 1 - Episode 42

Episode 7 years ago

Must Read: Circle Of Three - Season 1 - Episode 42

Sidi quickly dragged her away from the kitchen
to her room, while looking at her upset.
“Sidi, what’s wrong with you? How dare……..

Why are you crying?”
“Aunty Cassie, why you dey think like this? You
no even see me before you wan kill yourself.”
“Who told you I wanted to kill myself? I was
taking my drugs and you dare interrupt me?”
“Aunty, no vex but wetin you dey take na wetin
oyinbo call ‘overdose’. I dey hear am for
Channels the other day. Aunty, no lie to me,
you wan kill yourself.”


Cassie bowed her head down, knowing that she
has been caught fair and square.
“Aunty, why now? You no consider say you be
the best person I fit work with? Say that if you
die na to dey find madam up and down again?

You no consider aunty Ifeoma wey dey come
check you.”

Cassie looked at her and wondered what she
had in her ‘ant’ head. She decided to try.
“Sidi, wetin be your advice now?”
“Aunty, I no sabi everything, but I sabi say na
up to boy matter you wan kill yourself. I no sabi
wetin you and him do before but I no see
reason why you wan kill yourself for am.”


“Aunty Cassie, you are one of the best persons I
have met. You are kind, you are considerate
and you are patience.”
“Patient.” Cassie corrected her in her mind, but
she kept it to herself. This was Sidi’s hour.
“If na man wey dey worry you say you no go
marry, na lie be that one. You are too fine not to
marry and you have a good heart.”
“Aunty Cassie, just concentrate on your life and
school. I envy una wey fit go school like this
because una fit do a lot of things wey I no fit
do. If you don find something wey you like well,
well to do, you no go dey bothered. Life pass
the one of boyfriend oh! We humans no dey
nice to that extent. As you dey cry so, na so
one guy go dey cry too for somewhere say one
madam don cheat am.”
“Aunty Cassie, boyfriend/ girlfriend no too dey
bother me because I sabi say life big pass that
one. Na God and my own happiness dey
concern me, because if I no happy, no man fit
look my side.”
“Aunty Cassie, no vex oh but I go talk say make
you kokoma dey serious with God, because na
him sure pass. If you put your own life for man
hand, you don waste am be that. In fact, you
don scatter your life for ground if you think like
that.”
“When you decide to straighten your life and
hold it by yourself, when you decide that you
go carry your own life, with him cross and him
cake, na there you go dey happy and better
man fit come find you. Even then you go sabi
which one be better man.”
“So no take wetin happen too serious oh. Just
learn from it and continue your life. And if you
wan kill yourself, remember say I dey here oh!

Abeg I no fit dey find work.”

Previous Episode

Must Read: Circle Of Three - Season 1 - Episode 41

Next Episode

Must Read: Circle Of Three - Season 1 - Episode 43

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)