Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 9

Episode 7 years ago

Must Read: Adventures of big T - Season 1 - Episode 9

As I land like pilot wey no get parachute, me just enter ghost mode *dem no dey see me*. I just bend down near one tank like dat, so dat me go fit use eye take sample the area, the place be like one abandoned duplex. My mind dey read many things, because I just dey wonder why I enter this kind gbege! and matter con dey hard. But man na man, me no go relent, I must do wetin I fit do to save my yoruba love. Na so I sight two men, them carry gun and them be like soldier ant wey dey duty, from were I dey I just calculate my steps well, as I take wear my gun eem condom *silencer*. Me gum wall, like wall gecko, con waka small small reach were dem dey, na so I shoot the first one for head, before word fall from the other one mouth, him too collect him share. I con move their body put for conner, con search around, I no even hear any voice, the place be like grave yard.

I hold my gun well, me con open the door wey remote person enter the house. As I chook head enter the house, na so I hear gboa! for my head, my head read star like Tom and Jerry, I dey sure coco go grow come out. As I get my self, my gun done enter under one chair and the silencer don divorce my gun, this one na big f--k up ooo. Me con look up, na so I see person wey grab like Davido bouncer, con carry waist as if na Johnny Bravo. Before I know wetin dey sup, the guy carry chair won still knack me, na so I bend down take give am elbow for leg and con role comot from there. I con stand up, as I near am make I dash am my fist, na so I recive my own first for waist and chest, na blood turn close-up for my mouth, as my body shout ‘over load’. Na eem me con give am three round of blow for him body, the man no even shake at all, he just do like say he put foam for body. Na den I know say ee don red for me, I just waka dive am, the mumu follow me too dey run, for my mind I won do wetin Jet Lee dey do for film. I just count three legs for wall, con do back fleet take go the man back, as he look back I done already hold my gun. Na so I give bullet for body but he con dey do like Robocop, as he still dey struggle dey waka come my side, na so I give am last card, finishing for him head and con hala ‘check up’, as he take fall go ground.

The gun wey I shoot that time done wake people wey dey the house, as I dey smile say I don fall Goliath, na eem bullet fly pass me. I no even bother to look back, as ijump for the back of one big chair, the chair role go back as the chair turn shield. The shooting be like were compound to compound dey use banger fight, the chair wey I dey done dey bring smoke come out. As I look na five people I see, them done stop to they shoot, two of them done they waka dey come my side. Na so I use my Bullet Messenger *gun* take shoot them for chest, na eem I waka comot from that place. Na so one near me, as the man shoot, I just rush bend down give upper cut, as I take hold am for neck, con use the man as shield wen him fellow people dey shoot me, the man be like better brother keeper as he help me collect all the bullet for body. I just give the remain two better head shot, as them touch ground.

I search all the rooms I no dey see any sign of Seyi, my mind done over think wen I open the last door I just see her. I just stand like those three Eko statue wey dey hail you welcome to Lagos, na BOMB dey my yoruba love body. I waka near her, as I comot the celletape wey dey her mouth. “Baby please don’t touch it’ Seyi dey yarn. *her eyes done soak with pipe borne water*. I no talk anything as I waka go find phone, I collect one from one man like dat wen don puff. I dial Ufousky number, the thing say *the number your trying to call is incorrect, please check the number and dail again*, my mind fly, I try another one before the number con go, na so he carry phone.

“Hello, who’s on phone” Ufousky dey yarn. Na me Big T. “You never die, abeg the motor still dey if na wetin you want be that” Ufousky dey yarn. Abeg I wan make you help me diffuse one bomb wey dey my girl body *na so I describe am the type of bomb for am*. “Ok take better deep breathe” Ufousky dey yarn. I do do am. “Good, na how many wire you dey sight” Ufousky dey yarn. The wire many ooo. “Omo see gobe, na how many red dey there” Ufousky dey yarn. Na only one dey here. “Say you get anything wey you fit use take cut am” Ufousky dey yarn. Yes oo, small knife dey my hand. “Cut the red one, and tell me wetin happen” Ufousky dey yarn.

Hmmmmmm I still dey alive and the time stop con start again. “Ok, na how many minute remain” Ufousky dey yarn. Na 45 seconds. “Once the time knack 20 seconds, cut the green one” Ufousky dey yarn. Ok I done hear oo*23….22…..21…….baby I love you……..20* hello Ufousky you still dey dere because the time done stop. “Great job! Abeg go update ur status for facebook and Waploaded.com say you done disable bomb. You do well for me no worry I go use number as phone a friend for ‘Who Want To Be a Millionaire.

As me just comot the bomb from my yoruba love chest, na so my yoruba love hug me as if super glue dey between us. I con notice say person dey waka enter the room through the mirror wey dey the room. Na Fumnanya, as I wan turn back na so she shoot, but me just push my girl fall as I take pull two bullet for her chest. She just fall go ground, me con dey happy. Na eem MR. Awotunde just enter the room with two gun for him hand, as he take…

Previous Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 8

Next Episode

Must Read: Adventures Of Big T - Season 1 - Episode 10

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)