"Allow ads" and Popups to avoid redirection of your browsers.

Must Read: NYSC Tale: A Clarion Call To Confusion (18+)

Episode 7 years ago

Must Read: NYSC Tale: A Clarion Call To Confusion (18+)

“Guy what’s up? What’s the problem between you and your babe na?” I asked Yusuf when I got to the hostel.

“I don f*ck up again my man.”
“Wetin happen? I been see as she leave you waka for inside Pavilion.”
“Guy this whole thing started yesterday night.

We were sitting out in that corner close to the mango tree near the Pavilion. As we were gisting, I made a move to try my luck via small touching things but the girl no gree. I thought it was initial gra gra unto say this na something wey I don dey reason am with style before and she ma been dey flow with me then.

I been wan try again na e she just open eyes for me o. If no be say other people dey around for there she for shout for me. As she waka comot I come dey call am but she no gree answer me o.

Today I come meet her for my platoon but she just dey bone me. After so much trial and begging she come gree make we see this evening. On how we come sit for Pavilion dey talk, I dey try apologize but all of a sudden she just started calling me names o. just like that na e she waka comot o” he narrated pitifully.

“Omo your wey sha. You think say na as she dey follow you yarn the matter before, say she go follow you do am? You no try abeg.”

“Guy I know say me no try, but why the babe go come dey call me names sha?”

“You suppose dey happy say na only names na e she call you. What if she carry the matter go meet state coordinator? Na Molest attempt you for dey battle with now.”

“Taaar!! Molest attempt fire. Who go believe that kain yeye story?”
“Wait until e reach that time.”

“Guy but I like that girl. I no wan make she just waka like that. I go wan make we run package after camp o.”

“Oya go follow am talk na, she fit still reason with you.”

“As she take waka from that place ee, she no look like someone wey go ever follow me talk again. Abeg go follow am yarn on my behalf na abeg” he pleaded with me.

“You dey craze o. Wetin you wan make I go follow am talk? Say my friend na mad man ne e make em hand no dey stay one place? Guy forget am.”

“Abeg na just reason am anything, she go believe you.”

“Guy na your sh*t be that, you gats clean it up yourself.”

“My guy abeg na, I no wan lose that girl.” He pleaded on.

“Oya go meet am say all these things na.
she go believe you.”
We were still talking when some army men stormed our hostel and started searching bunk to bunk for people who might have illegally connected electricity to an extension wire.

After checking through the bunks, they left after warning us to sleep and not keep making noise as we might not like what they will do to us if they come back.

As the army guys left, it crossed my mind that I have not heard from Shania the whole evening.

I dialed her number twice but got no reply but when I checked her Whatsapp profile, she was online. I couldn’t think of any reason why she wouldn’t pick my calls. I sent her double messages asking about her day and why she wasn’t picking my calls. After a while, I saw an indication showing that the messages has been read but I got no reply. Since she doesn’t want to talk with me, I switched off my phone and slept off.

Previous Episode

Must Read: NYSC Tale: A Clarion Call To Confusion (18+)

Next Episode

Must Read: NYSC Tale: A Clarion Call To Confusion (18+)

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Nancy Drew S01E07 - THE TALE OF THE FALLEN SEA QUEEN
episode | 4 years ago

Nancy Drew S01E07 - THE TALE OF THE FALLEN SEA QUEEN

The Handmaids Tale Season 3 Episode 13
episode | 4 years ago

The Handmaids Tale Season 3 Episode 13

The Handmaids Tale Season 3 Episode 12
episode | 4 years ago

The Handmaids Tale Season 3 Episode 12

The Handmaids Tale Season 3 Episode 9
episode | 4 years ago

The Handmaids Tale Season 3 Episode 9