Brouhaha In The House Of God (16 +) - Season 1 - Episode 2

Episode 8 years ago

Brouhaha In The House Of God (16 +) - Season 1 - Episode 2

I heard a big sound from our front like a splash or something, i look that area i nor see anything.
Felix: wetin be that?
Me: e be like say na big fish oh but i nor see anything.
Then i heard the sound again, this time closer omo this fish go big oh, the thing they swim come meet me self with boldness, i never still know wether na fish or not and i don dey fear,
Felix: commot for river, na big fish be that oh make i face am alone.

I ran out of the big river while felix stood at the middle holding his matchet like matchete with confidence like rambo.
Then i saw it from where i stand, a very mighty fish like arrow head, swimming close to felix, i started shouted shouting.
Me: bros bros commot for the river, that fish too big oh e get arrow head oh, you nor go fit kill am.
Felix: keep quiet make you nor scare am that chemical don weak am so e no go dey strong no worry my guy.

Omo make una come see action film, as the fish swim closer to felix, felix rose his matchet and hit the fish on the head, then there was silent, no blood, nothing at all, after a minute something took felix down the river, then the thing started dragging felix to the bottom of the river, i ran after it shouting, make una help oh, make una help oh something don carry felix oh.
The thing they drag felix to a very deep place and na only God go help am if them enter the deepest,.
Then from nowhere, i saw my brother and other people running after me from my back, e be like say them hear my voice.
Cactus: oz wetin they happen,why you they shout and run,.
me still running after the fish breathing heavily, point at felix as the fish continue dragging him, my brother saw it see the way wey im take run pass me like usain bolt them say him dey win 100 metre race for school i nor believe but now i believe (we nor go the same school)
Felix was struggling trying to free himself from the grip and the fish was slowing down still holding hom tight, my bros took bamboo wood from the ground and ran to the front, before the deepest part there is one big tree that fell on the river creating a crosspart, my brother quickly climb the tree, i reach there omo i nor fit climb this tree oh e dey too tiny, even the other guys no climb am, maybe na boyscout wey my brother join give am mind like that my brother set the bamboo tree downward as the fish approach, e be like say the fish don tire because e don they slow down, so as the fish approach the tree, felix rose his hands up and grip the bamboo stick, the fish still try to pull felix from the bamboo, therefore making my brother to fall inside the river, as my brother fell ontop the river, i quickly look for another bamboo and throw it to them, e be like the fish don go, because i nor see am again, my brother drag felix from the river as he grip the bamboo, while i pull them from the deep blue sea with felix bleeding badly.
We got home rush felix to my mum hospital, i came back and look at the time, 6:30pm,
TIME STILL DEY TO GO CHOIR PRACTICE ABI?

I took my bath wear my clothes and took my choir book as i hed straight to church, for my village them say if them they do their festival, no church for that area they beat drum, the law still stand till now..
Omo i don late oh, i thought as i hear my choir member from afar practicing singing with their loud voice.
Our church na big church with big fence, e get three big door, and 2 store for instrument and for choir.
I open the big gate as i enter, i pass through the choir door and gently walk in and sat at the back where nobody will notice me, i look forward and saw my crush mabel, people dey sing she they press phone chai,.
I sat at the back as we continue practicing i nor even greet them, then after like one hour of practice, time for discussion.
While them they discuss i took my kpako xpressmusic out and login 2go, i saw mabel online, waoh so this girl they chat for inside church, so i send her a message.
“na for inside church you they chat?”
she replied.
“na wetin carry you come online?”
Me: na you na.
Mabel: how e take be me?
Me: i see say you nor they flow with the discussion so i decided to check whats distracting you and i was right.
Mabel: lie lie.
Me: no be lie oh, you better concentrate oh.
Mabel: ok i will, and you too.
Me: no oh me i nor fit concentrate na.
Mabel: why?
Me: why? How can i concentrate when you are here.
Mabel: i dont understand.
Me: well i mean i cant concentrate because your beauty alone is a distraction.
Mabel: hahahaha abeg stop that joor, ugly girl like me.
Me: nah, even a blind man will notice your beauty when you pass.
Mabel: na when you come grow mind like this?
Me: grow mind as in?
Mabel: you wey no dey get mouth talk before na who come dash you mind?
Me: na God, e be get one thing wey i wan tell you self.
Mabel: wetin be that.
As i say make i reply her na im our choir master waka come back jejely carry my phone.
Choir master: so Oz please tell us what do you think about the suggestion?
Me: what suggestion?

Choir Master: now why would you know when you were busy pressing your phone?
Wetin dey worry am self, na only me im see, im no see mabel abi?
Me: i was switching it off.
Choir master: thats your own concern, you get the phone back after the lord’s prayer, bose said we should use half our money to buy amplifier for the church i ask you what you think?
Me: yes, since our amplifier develop fault everyweek, i think it will be wise if we buy amp with our harvest money.
Choir Master: ok thank you, you can sit down.
I sat down and look at mabel, she wink at me and tease me with her tongue, so after the lord’s prayer i took my phone back from our choir master, i look around and saw mabel going already,. I ran after shouting her name, she saw me running after her as she approach the gate, so she wait for me.
Mabel: so you want tell the whole village say i dey choir practice abi?
Me: no vex na i just wan escort you go house, i said as we continue walking.
Mabel: and i tell you say i nor fit go house myself.
Me: no na, i nor want make those yeye guys begin they disturb you for road na.
Mabel: hmmm so you nor be yeye guy.?
Me: me na correct guy na.
Mabel: i hear you Mr correct man, by the way wetin you be want tell me for church before choir master seize your phone.
Me: well eeeerrrr
i scratch my head as i think what to tell her, the truth is that to express your feelings online can be so easy but when you meet face to face everything in your head will disappear,
Me: i just wan tell you say you look beautiful.
Mabel: well you told me that before.
Me: yes i wan just tell you again.
She pause look at me with her charming eye like dechandel then raise her hand like say she want to say something, then she put it down and continue walking as her big butt0ckz blow groundnut behind her like mercy johnson.

Previous Episode

Brouhaha In The House Of God (16 +) - Season 1 - Episode 1

Next Episode

Brouhaha In The House Of God (16 +) - Season 1 - Episode 3

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)